Royal Wedding 2018: See as pipo shine for Prince Harry and Meghan Markle

Published

Ogbonge Tennis player Serena Williams, actors Idris Elba and George Clooney and singer Elton John dey among di 600 guests for Prince Harry and Meghan Markle wedding.

Doria Ragland
Wetin we call dis foto, Mama of di bride Doria Ragland dey very touched, as she dey wait make di ceremony start.
George Clooney and his wife Amal Clooney
Wetin we call dis foto, Ogbonge Hollywood actor George Clooney and im wife Amal Clooney.
The Queen
Wetin we call dis foto, Di Queen na di last guest to enta church, she wear lime green hat to match her dress.
Wetin we call dis Video, Royal Wedding 2018: How Meghan fit change Britain royalty
Di Duchess of Cambridge and her daughter Princess Charlotte
Wetin we call dis foto, Di Duchess of Cambridge and her daughter Princess Charlotte as dem dey go di church.
Earl Spencer and his wife Karen
Wetin we call dis foto, Earl Spencer co-ordinated his tie with the purple dress and cape combination of his wife, Karen.
Princesses Eugenie and Beatrice with dia papa Duke of York
Wetin we call dis foto, Prince Harry cousins dem, Princesses Beatrice and Eugenie with dia papa Prince Andrew.
Sarah Ferguson
Wetin we call dis foto, Sarah Ferguson mama of Princesses Beatrice and Eugenie.
Idris Elba, his fiancee. Sabrina Dhowre and Oprah Winfrey
Wetin we call dis foto, Idris Elba hold di hand of im fiancée Sabrina Dhowre as dem arrive for di church service. Oprah Winfrey follow dem for back she wear pale pink dress.
Serena Williams and her husband
Wetin we call dis foto, Serena Williams bin post for Instagram say she don ready for her "friend' wedding"
James Corden and Julia Carey
Wetin we call dis foto, Presenter for Late Late Show James Corden come with im wife Julia Carey
Sofia Wellesley and James Blunt
Wetin we call dis foto, Prince Harry long-time friend, singer James Blunt, come with im wife Sofia Wellesley, wey wear very colourful collared dress and pale yellow hat
Patrick J Adams and Troian Bellisario
Wetin we call dis foto, Patrick J Adams, Di TV husband of di Duchess of Sussex, dey dia to watch her marry for real-life.
Wetin we call dis Video, Royal Wedding 2018: Prince Harry and Meghan Markle love tori
Sarah Rafferty in an embellished navy dress and hat
Wetin we call dis foto, Meghan best friend for TV, Sarah Rafferty, follow come
Singer Joss Stone in a floral dress and rugby player James Haskel arrived with im fiancee Chloe Madeley
Wetin we call dis foto, Singer Joss Stone wear floral dress and rugby player James Haskell come with im fiancee Chloe Madeley
David and Victoria Beckham
Wetin we call dis foto, David and Victoria Beckham wear to match midnight blue colour.
Cressida Bonas and Chelsy Davy
Wetin we call dis foto, Prince Harry former girlfriend dem Cressida Bonas and Chelsy Davy come too for di wedding.
Prince Harry and Prince William
Wetin we call dis foto, Prince Harry and im senior brother, di Duke of Cambridge.
Doria Ragland and Meghan Markle
Wetin we call dis foto, Meghan Markle, and her mama Doria Ragland inside di car wey carry dem go St George's Chapel.

All pictures subject to copyright.