Musk say Twitter fit see 'slight cost' for businesses and governments

Elon Musk arriving at the 2022 Met Gala.

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 2 mins

Business and goment users on Twitter fit pay a "slight" fee to stay for di social media platform, Tesla boss Elon Musk tok.

Dis dey come afta di board of Twitter agree to $44bn (£34.5bn) takeover offer from Musk.

But, Musk say di site go always dey free for "casual users".

E bin don tok before say e want to "make Twitter better than ever by enhancing di product wit new features".

Twitter no respond to BBC request for comment.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Earlier, oga Musk bin tweet a link to one CNN story wey call for some of di US' biggest brands to boycott Twitter if Oga Musk roll back content moderation policies wey go limit hate speech.

Im argue say Twitter moderation policies na threat to freedom of speech.

Since e agree to buy Twitter, Oga Musk say e want to make improvements to make am more attractive e describe di platform as "niche".

E say e go introduce new features, and suggest changes for dia new premium subscription service, Twitter Blue, including cutting dia price.

Di paid-for extra service go add features such asan "undo tweet" button, bookmarks, and a reader mode, Twitter tok.

Oga Musk also say im wan remove spam bots from di platform and authenticate all real people.

On Monday for di annual Met Gala for New York, e say e go make Twitter transparent on how tweets dey promoted or demoted and want dia software to dey available for public scrutiny.

Meanwhile, di multi-billionaire don tell potential investors say e fit return di social media firm to di stock market in a few years.

Oga Musk plan to sell Twitter shares again as little as three years afta e buy am, according to di Wall Street Journal, wey cite pipo wey dey familiar wit dimatter.

Him takeover of di company go dey completed later dis year, subject to conditions wey include di approval of Twitter shareholders and regulators.

Under di deal him go buy all di shares for di company wey currently dey available for stock market, e go take am from being a publicly-owned company to a private one.

Last week, Oga Musk bin sell roughly $8.5bn worth of shares for Tesla, wey bin lead to speculation say him go use di money to help finance im buyout of Twitter.

Shares for di electric car company bin lose more than 20% of dia value in di last month, sake of concerns say Oga Musk go sell part of im stake for di company to fund di deal.

Oga Musk na di world's richest person, wit an estimated net worth of around $250bn, mostly due to im Tesla stake.

Him also get a controlling stake for di rocket company SpaceX, wey dey estimated to be worth $100bn.

line