Russia and Ukraine war 2022: Fotos plus latest updates from day five of Ukraine-Russia invasion

Wia dis foto come from, Getty Images
As Ukrainians wake up to day five of air strikes and full blown war as Russian troops dey move closer to di capital of Kyiv.
Pipo dey hear blasts for Kyiv and Kharkiv dis morning, as one residential building for di northern city of Chernihiv dey hit by missile.
Fifa and Uefa on Monday suspend all Russian clubs and national teams and tok-tok start for Belarus between Kyiv and Moscow to de-escalate di kasala.
Even as both citizens and foreigners for Ukraine still dey find dia way out of di kontri with all di kasala.
Russian football clubs and national teams don chop suspension from all competitions by Fifa and Uefa afta di kontri invasion of Ukraine.
Di world and European football governing bodi say dem dey banned "until further notice".
E mean say di Russian men team no go play dia World Cup play-off matches next month and di women team don chop ban from dis summer Euro 2022 competition.
Spartak Moscow don also dey kicked out of di Europa League and dia last-16 opponents RB Leipzig go advance to di quarter-finals.
End of Di one wey oda users dey read well well
Uefa don also end dia sponsorship wit Russian energy giant Gazprom.
"Football dey fully united here and in full solidarity wit all di people wey dey affected for Ukraine," Fifa and Uefa tok for one joint statement.
"Both presidents hope say di situation for Ukraine go improve significantly and rapidly so dat football fit again be vector for unity and peace among pipo."
Fifa and Uefa bin decide to take action afta Russia, dey supported by Belarus, launch one military invasion of neighbouring Ukraine last Thursday.

Wia dis foto come from, Getty Images
Tori bin comot from di borders to Poland say discrimination bin dey against African student but now e be like every pesin don land for di kontri.
As at now Nigeria and Ghana don dey push to get dia citizens back home.
Nigeria goment reveal for statement say dem dey expect dia batch two of 200 Nigerans citizens for Budapest, Hungary by Monday.
Dem bin report say so far dem get 204 Nigerians ova di border to enta Bucharest, Romania and Budapest, Hungary and 52 Nigerians for Warsaw, Poland.

Wia dis foto come from, EPm
Meanwhile, tok-tok hold between Russia and Ukraine on how to end di kasala for di region.
Both sides go return to dia capital cities for consultation ahead of a second round of toks wey fit take place in di days, di Reuters news agency cites Belarus' Belta news for di informate.
Expectations for a peaceful resolution no too dey high before Monday meeting.
Ukraine say dem want ceasefire and Russian withdrawal, while di Kremlin say dem no go announce dia position.
Russia negotiators bin tok of striking one deal wey go dey in di interests of both sides.

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile di United Nations dey hold session for dia Human Rights Commission on Monday.
Di extraordinary Session na Kyiv request am as urgent meeting for Geneva into di Russian invasion of Ukraine.
President of di UN General Assembly Abdulla Shahid don ask all kontris to demonstrate moral courage and give peace a chance as dem gada for di United Nations General Assembly 11th emergency special session to discuss di Russia - Ukraine crisis.
Di presido remind di special session say all di 193 kontris for di world get say for di General Assembly unlike di Security Council wey get five permanent, veto-wielding members and 10 non-permanent members wey hold two-year terms.

Wia dis foto come from, Nana Addo Dankwa Akufo Addo
West African Regional Bloc ECOWAS don condemn Russia's invasion of Ukraine wey don cause human casualties, especially civilians.
Di regional body for one statement don beg both parties to ceasefire and use dialogue to resolve di ongoing crisis.
ECOWAS don also call on di two kontris to ensure di safety of citizens of im 15 member states wey dey live for Ukraine.

Wia dis foto come from, Getty Images
About Fifty pipo, mostly womengada for di Russian Embassy for Abuja, Nigeria capital for peaceful protest sake of di Russia -Ukraine katakata.
Di pipo wey comprise women, men and youths, say di protest na to call for peace for between Russia and Ukraine.
Dem say since di katakata start dem neva hear from hear from dia children, siblingsand friends.
And di uncertainty weda dem still dey alive maim dey trouble dem.












