Davido: Nigerians react afta singer Davido raise ova '40 million naira in one hour'

Published

Davido name na top trend for Nigeria social media space afta di musician share video say make im friends send am money.

Just some minutes afta im share di post, di artist wey im real name na David Adeleke later share one screengrab of im bank account on Twitter wia im say fans don send millions of naira one hour afta im ask dem to.

"If u sabi say I don give una hit song .. send me money," Davido tweet before im start dey share updates of how dem don send am di money dem.

Im also post video wia im tok say "I wan sabi who my friend be, If you know you be my friend , send me 1million Naira.

Di video don since go viral as alert begin drop for di singer account.

Im later tweet say dem don raise 7m naira ($16,000; £12,000) in just 10 minutes, and joke say im target na 100 million naira because im wan pay off one loan wey im don take for im Rolls-Royce car.

Im latest tweet say im don raise over 90m naira.

Dis plea by Davido don spark reactions from Nigerians wey don begin chook mouth on di amount of money wey di singer say im don raise.

Wetin to know about Davido

Nigerian musician, Davido don make many music since im start im career for 2010.

Born on 21 November, 1992 di Nigerian-American singer na heavyweight for Nigerian music industry

Forbes for 2020 label Davido as Afrobeats superstar. Dem say e be one of Africa biggest musicians.

Since im rise to fame, Davido don win multiple awards, including BET awards and MTV awards. He also dey signed on many endorsement.

For 2008, he make di Forbes Africa 30 Under 30 list.

Davido get 9.7 million followers on Twitter.