Germany and Belgium flood pictures of how pipo die and communities destroy

A general view of flood-affected area following heavy rainfalls in Schuld

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Flood damage in Schuld, Germany
Published

Serious floods don hit some parts of western Europe afta record rainfall make swollen rivers to burst dia banks.

At least 100 pipo don die for Germany and 22 deaths dey reported for Belgium.

Forecasts suggest say more heavy rain go still fall for most of di region on Friday.

Flooding for Cologne, Germany in July 2021

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Rhine river flood di German city of Cologne on Thursday
Flooding for di Belgian city of Verviers, July 2021

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Cars do somersault for streets of di Belgian city of Verviers

Some of di most dramatic images come from di German village of Schuld, for Ahrweiler district of Rhineland-Palatinate, where goment don declare state of emergency.

Your device may not support this visualisation

Some 200,000 homes no get light again.

Thousands of relief workers and soldiers dey help police with search and rescue efforts.

One road wey spoil dey next to di Ahr river

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Roads wey floods destroy for Schuld
A van crushed by the torrents is pressed against a tree in Germany

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Vehicles dey crushed and flood water carry am throw way for Bad Neuenahr-Ahrweiler

Heavy rains also happun for Switzerland, Luxembourg and di Netherlands, where dozens of people don dey evacuated from their homes.

One womantryto move in a flooded street in Liège, Belgium

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Di Belgian city of Liège also dey hit by heavy flooding, di mayor don tell pipo to comot di city if dem fit
Di fire brigade evacuate pipo from their homes for South Limburg, di Netherlands, 15 July

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Di fire brigade dey help to evacuate pipo for South Limburg, di Netherlands
A mobile flood barrier is seen along the Reuss River in front of the Kapellbruecke bridge in Lucern

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One mobile flood barrier don dey installed for Lucern, Switzerland

All photos are subject to copyright.