You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Sheikh Gumi deny reports say DSS invite am for questioning
Controversial Nigerian cleric Sheikh Ahmad Gumi don deny reports say di Department of State Services, DSS bin invite am for questioning.
According to Channels Television, Sheikh Gumi bin say all im speaking with di bandits inside di forest na someting im bin do in collaboration with di support of di government and security agencies, so e no commit any offence.
"Nobody Invite me for questioning or any arrest, I fit say dat one categorically," di Sheik tok.
Dis one dey come afta reports say DSS say dem invite Sheikh Ahmad Gumi to come ansa some questions.
Tok-tok pesin for DSS, Peter Afunaya, bin tell local tori pipo Channels TV say dem true-true invite am, say na normal tin for dem "to invite any pesin of interest."
All dis one dey come afta one interview di cleric do with tori pipo Arise TV recently, on Wednesday, 23, June 2021.
Inside statement wey di Nigerian Army release, dem bin deny accuse wey Gumi sama dem for di interview say some officials dey collabo wit bandits to commit crimes against Nigerians.
"Di sweeping accuse wey di scholar tok no only dey sad and unfortunate, but na also calculated attempt to unfairly criticise di Nigerian military and yeye di sacrifice wey our patriotic troops."
End of Di one wey oda users dey read well well
But dem add say dem no go attempt to deny say "e possible say black sheep dem among dem."
Di proscribed Ipob also release statement say, di claim by Sheikh Gumi for di interview say dem dey kill northerners for South East region of Nigeria no be true.
Ipob for statement say di killing of herdsmen na "necessity to defend dia "ancestral land" and dia women from rape and attacks without justification.
Dem add say no northerner for any part of Igboland fit prove say dem attack dem.
Wetin Gumi tok?
Oga Gumi say, wetin Nigeria dey call banditry na actually 'tribal war' and goment no suppose take side becos once goment support one side den dem don become part of di conflict.
"Dis na wetin I see for Zamfara state, for Niger state and oda states. Dis na tribal war and di goment dey take one side."
On di oda hand, di sheikh add say, dis bandit mata na business and many of dem dey collabo wit "a lot of bad element for our security system. Dis na business and so many pipo get hand inside, e go shock you."
E say na dis collabo make am possible for plenty big weapons to cross di kontri border enta di forests.
'Protests in London'
Meanwhile, Nigerians from Igbo tribe, wey dey stay for London, Britain, cari waka enta Trafalgar Square on Friday, 25 June, go all di way to di house of di British Prime Minister Boris Johnson, to protest di killing wey dey happun for south east of Nigeria.
"Dis gathering na about di killing of igbo pipo for south east, make dem stop, make di military stop killing di igbo pipo, make di police stop killing di igbo pipo make dem stop shoot at sight, make dem stop search and flush for Nigeria."
Di protesters tell BBC Pidgin say, di koko of dia gathering na to ask goment make dem restructure di kontri and if restructure no work, make dem allow pipo become autonomous or make everybody find dia way.
'Operation restore peace'
Nigeria goment begin Operation Restore Peace in South East, di Igbo speaking region of di kontri, reports say di operation don lead to di killing of some youths wey be alleged members of di proscribed Indigenous Pipo of Biafra (IPOB) and dia Eastern Security network (ESN), group wey dey demand for dia own kontri, Biafra.
Di military operation na in response to di recent breakdown of law for di region wia unknown gunmen bin dey burn goment properties - prison, police stations and Inec office - kill goment agents particularly police and burning of
politicians house for di region.
We don update dis tori.