Champions League Final: Chelsea defeat Manchester City to win UCL trophy

Kai Havertz scores for Chelsea
Published
Read am in 2 mins

Chelsea don defeat Manchester City to win di Uefa Champions League for di second time in di all-Premier League confrontation wey happun for Porto.

Kai Havertz goal wit di help of Mason Mount for di first 40 minutes of di game cari di win give Thomas Tuchel side over Pep Guardiola Man City.

City, bin try to recover from di rest of di match but di game no go dia way.

Di game wey end at 0-1 and give Tuchel im first ever Champions League Title as Chelsea manager.

Chelsea's Thomas Tuchel

Chelsea get di beta opportunities throughout, Timo Werner waste two good chances before Havertz strike and substitute Christian Pulisic also waste another chance for di second half of di match.

Pep Guardiola
Wetin we call dis foto, Pep Guardiola afta di match

See how fans take react to Chelsea win

Na jubilation mood all di Chelsea for di world day at di moment as di Blues win dia second Champions League Title.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Skip X post, 2

End of X post, 2

Ex Chelsea player Didier Drogba write for Instagram post '' We believed. Dey believed.''

Chelsea celebrate
Chelsea celebrate