Rock & Roll Hall of fame: Nigerians para as Fela fail to make di 2021 Rock & Roll inductees list

Rock and Roll nomination photo of Fela Kuti

Wia dis foto come from, Rock Hall/Twitter

Wetin we call dis foto, Rock and Roll nomination photo of Fela Kuti
Published
Read am in 2 mins

Nigeria afro beat legend Fela Anikulapo Kuti no dey among di nominees wey dem go induct into di 2021 Rock & Roll Hall of Fame.

For February 10 dis year di Rock Hall voting bodi list nominees from all over di world as potential inductees as dem open am for different categories - rap, pop, R&B, metal and Afrobeat.

Di organizers list Fela among oda top musicians wey don make dia mark for international music scene and wey don release albums wey don last up to 25 years.

Di total number of di nominees na sixteen wit seven of dem wey be females.

Dem also open voting for fans to vote dia favourite nominees into di Hall of fame.

But as dem announce di names of di nominees wey dem go induct Fela name no follow.

Name of Rock & Roll 2021 inductees

Wia dis foto come from, Rock Hall/Twitter

Wetin we call dis foto, Name of Rock & Roll 2021 inductees

Di 36th Annual Rock & Roll Hall of Fame induction ceremony go hold on Saturday, October 30, 2021 for Ohio, USA.

"Dis diverse class of talented Inductees reflect di Rock Hall ongoing commitment to honor artists wey dia music create di sound of youth culture", tok John Sykes, Chairman of di Rock & Roll Hall of Fame Foundation for statement wey dem publish for dia website.

Who make di inductees list?

For di announcement, eight-time Grammy awards winner and "Queen of Rock 'n' Roll" Tina Turner, American Rapper Jay Z, Todd Rundgren, The Go-Go's and Fof Fighters be di five ogbonge musicians wey dem select as inductees for di 2021 clas of Rock & Roll Hall of Fame.

Why Nigerians dey para?

A look at di voting board result show say Fela na im come second but organiser say dem tally dis result wit odas before dem reach di final selection process wey dem use choose di 2021 Inductees.

Di result wey dey show for di voting board fit be di reason why some Nigerians no dey happy say Fela name no dey among di top 5 musicians wey dem go induct.

Outcome of Rock & Roll voting as published by di organizers

Wia dis foto come from, Rock Hall/Web

Wetin we call dis foto, Outcome of Rock & Roll voting as published by di organizers

Di organizers say dem tally dis result wit odas before dem reach di final selection process wey dem use choose di 2021 Inductees.

Femi Anikulapo Kuti, Fela son don dey busy dey calm supporters down say make dem no over react.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Fans react to Rock and Roll announcement

Wia dis foto come from, TWITTER

Wetin we call dis foto, Fans react to Rock and Roll announcement
Fan react to Rock and Roll announcement

Wia dis foto come from, TWITTER

Wetin we call dis foto, Fan react to Rock and Roll announcement
Fan react to Rock and Roll announcement

Wia dis foto come from, TWITTER

Wetin we call dis foto, Fan react to Rock and Roll announcement
Femi Kuti tell fans to calm down

Wia dis foto come from, TWITTER

Wetin we call dis foto, Femi Kuti tell fans to calm down