January transfer window: Meet Ozan Kabak wey Liverpool sign on loan and odo done deals

Ozan Kabak

Wia dis foto come from, Getty Images

Published

Liverpool don complete di loan deal for Turkey central defender Ozan Kabak wey bin dey play for Schalke.

Kabak deal wit di Reds na until di end of di season, di club also don sign former Preston North End player Ben Davies for £2m.

Defender Davies, wey be 25 years, sign "long-term" deal for Anfield.

Di Reds bin dey eye Marseille Duje Caleta-Car, sake of all di injury wahala wey dem get for dia defence.

Liverpool get option to buy Kabak for £18m - with add-on clause dem - at di end of di season, but dem no go activate dat one until June.

For now, dem go pay £1m loan fee first wit extra £500,000 based on games played and how dem perform for Champions League.

Who be Ozan Kabak?

Ozan Kabak

Wia dis foto come from, Getty Images

Kabak na 20 year old defender wey start im career for Galatasaray.

Im play 17 times for dem before in join German club VFB stuggart for January 2019.

Kabak bin get regualar shirt for Stuggart wia im score three goals for 2018-19 season but di club suffer relegation.

Afta im leave Stuggart e move go Schalke.

Even though im be defender one of im strengths na heading di ball. For one interview wey in do wit Bundesliga website e say I go say my heading ability dey good, because I score a lot with my head before for Galatasaray.

"Physically like pace and jumping I dey good."

Dis na as clubs attempt to conclude any last-minute deals during Monday deadline day.

Wit di financial palava wey coronavirus don cause, na only five players dem don sign for January, plus several loan deals, tori be say tins fit dey quiet for many clubs wit only few hours of di window remaining.

Premier League spend £230m during 2020 January window, di second-highest total in history, but only £25m of that money come on di last day of di window.

Dis time around [2021 transfer window] only four clubs don spend money on signing players.

Manchester United pay £19m for Amad Diallo, Aston Villa sign Marseille midfielder Morgan Sanson for a reported £16m, West Brom buy Robert Snodgrass for an undisclosed fee and West Ham don make Said Benrahma loan move permanent for £20m.

Di last time wey Premier League clubs spend less than £100m for January window na for 2012, wen dem spend £60m for transfer fees.

Di transfer window go close for most of Europe on Monday.

Dele Alli go leave Spurs? Christian Eriksen go return back Premier League? Which clubs go make their moves as di clubs battle for di title, for Europe and relegation survival dey hot?

[Transfer news]

Odion Ighalo

Latest transfer news: When be deadline day around UK & Europe?

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Odion Ighalo na one of di big names to move on transfer deadline day last year, wen im join Manchester United from Shanghai Shenhua

Odion Ighalo dey on di verge of joining one club for Saudi Arabia according to reports.

Ighalo wey just just end im loan deal for Manchester United where him stay for a year and score five goals in 23 appearances.

Tori be say di 31-year-old dey due to return to im parent club, Shanghai Shenhua but Skys Sport reports that the Chinese side don give am permission to tok wit another club.

According to di report, di move dey subject to medical and personal terms but e dey likely say di deal go go through.

Di transfer window for Saudi Arabia go close for February 7.

Arsenal

Arsenal boss Mikel Arteta don admit say di club dey in toks to send some young players out on loan "for dia development".

Players wey fit go outt on loan include Reiss Nelson, Joe Willock and Ainsley Maitland-Niles. Di club dey also look at di possibility of selling defender Shkodran Mustafi or better still end im contract.

Leicester City

Dia manager Brendan Rodgers say he want bring in one midfielder.

Tori be say di Foxes dey eye Arsenal Ainsley Maitland-Niles and Watford midfielder Nathaniel Chalobah

West Brom

Di Baggies boss Sam Allardyce also dey linked with Maitland-Niles.

Oga Allardyce na one of di busiest manager during di January window wit three signings, but e say him wants another two before di window close.

Fulham

Fulham manager Scott Parker dey keen to add one striker to im squad but im no dey confident say im fit securing a deal before di window close.

Tottenham

One of di major talking point for di transfer window na whether out-of-favour Tottenham attacker Alli go leave di club, as dem dey link am wit move to Mauricio Pochettino wey dey Paris St-Germain.

But Tottenham manager Jose Mourinho say im no expect dat to happun.

When be deadline day dis year?

Latest transfer news: When is deadline day around UK & Europe?

Wia dis foto come from, BBC Sport

As 31 January fall on Sunday, di transfer deadline for Premier League and EFL clubs na at 23:00 GMT on Monday 1 February.

For Scotland, di window go close an hour later for 00:00 GMT.

Dis go be di start of a busy week, wit full round of Premier League fixtures on 2 and 3 February.

How about around Europe and elsewhere?

For Spain, France, Italy and Germany dia deadline also na February.

And for La Liga and Ligue 1, di window go close at 23:00 GMT, for Serie A di deadline na 19:00 and for Bundesliga na 17:00.