You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
School resumption date in Nigeria: ASUU strike latest as NLC, TUC call off nationwide protest
Few hours afta federal goment reach agreement wit di Nigeria Labour Congress and di Trade Union Congress wey make dem suspend di industrial action dem bin plan to carry out on Monday, pipo, particularly students dey wonder why ASUU strike still dey go on and wen e go end.
ASUU - di joinbodi of university lecturers for Nigeria start nationwide strike on Monday 23 March, 2020 till further notice to call goment attention to di demands wey dem don dey ask since.
Wetin be di latest?
Di faceoff between Nigeria goment and di Academic Staff Union of Universities no go end anytime soon as goment and di striking lecturers dey blame each oda for di continuous University strike wey don pass over six months.
Di Chairman Lagos State University, Dr Issac Oyewunmi tell BBC Pidgin say dia resumption dey goment hand. He say dem don tell goment wetin University need to survive and not until goment behave, di strike go continue. Oga Issac add say na goment go tell dem if dem wan continue to dey run di University or dem go close am as long as dem wish.
For im reaction to di labour unions strike wey dem suspend, di ASUU Chairmo say di academic staff union different from oda labour unions and di principles ASUU dey work na high level. high level. He explain say di carrot and stick game goment dey take play wit oda unions no go work wit ASUU.
Wetin FG dey tok?
Di tok tok pesin for di Federal Ministry of Education, Ben Goong however say na ASUU still dey drag di mata because dem no wan register for di Integrated Payroll and Personnel Information System (IPPIS).He say school resumption dey dia hand and no be goment dey delay am.
Wetin be ASUU demands for di ongoing strike?
ASUU dey disagree with di goment on top di use of di IPPIS. Di joinbodi tok say dem no fit register for IPPIS as di payroll application no go fit work for some special activities of im members.
Di union National President Biodun Ogunyemi say di IPPIS operators dey short change members salaries.
End of Di one wey oda users dey read well well
ASUU come develop im own payroll application, wey dem call the University Transparency and Accountability Solution (UTAS) and tell goment say na only dis application dem go gree use.
Apart from di IPPIS and salary matter, di joinbodi also dey hold goment to honour di agreement wey di two parties agree for 2013, wey dem finalize again for February 2019.
Di issues for di memorandum of understanding na on top lecturers welfare and proper funding of universities for Nigeria.