You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Lagos government wan 'upgrade' slum communities - See how e go affect you
Goment for Lagos state say dem wan begin upgrade some slum communities for di state to improve di living standard of pipo wey dey live dia.
General manager Lagos state Urban Renewal Agency LASURA Ajibike Shomade say dia target na to achieve 5% annual reduction in number of slum communities for di south west state of Nigeria.
Goment say dem wan make di communities dey well equipped wit beta facilities to help pipo wey dey live dia.
See di affected communities:
- Ilasan Housing Estate
- Ikota Housing Estate
- Adeniji-Adele Housing Estate
- Makoko Community
- Some parts of Shomolu/Bariga
- Ifelodun/Ijora-Badia
- Obalende
- Isale-Eko
- Ebute-Ero
Wetin dis 'upgrade' mean?
According to report from goment, while dem go upgrade some of di places for di communities, dem go also go scatter some of di buildings and structures dia.
Wetin e mean say pipo for dia fit loose dia homes.
But di Commissioner for Information Lagos state, Omotosho Gbenga tell BBC Pidgin say, dia plan na to rebuild di area and make am more comfortable for di inhabitants.
"We no plan to pursue di pipo dia but wetin we dey do na to improve dia living standards, we go build new houses, schools and health centres dia and na dem go enjoy evritin wey we wan build for dia". Omotosho tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
E say di plan na ongoing project say dem don already start work for OkoBaba and dem don build new resettlement for Agbowa for pipo wey bin dey OkoBaba. Na after dat one dem go begin work for di oda new communities.
Lagos urban renewal law 2015 - 2025 give goment power to clear areas wey no dey too good for pipo to live and to upgrade such places.