You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
ACM Awards 2020: See list of ogbonge singers wey win di Academy of Country Music Awards
Two America country music singers, Thomas Rhett and Carrie Underwood na im share di Entertainer of di Year award during di at the 55th Academy of Country Music Awards (ACM) wey happun live on Wednesday night.
Dis na di first time for di ceremony 55-year history wey two tie dey for Entertainer of di Year honours.
Di event wey bring togeda di biggest names in kontri music suppose happun for April 5, but dem delay am until yesterday night because of di coronavirus pandemic.
Keith Urban na im hosted di event from di Grand Ole Opry House with no audience sake of di Covid-19 pandemic, but the show dey full with entertainment.
Among di pipo wey perform na Taylor Swift, Carrie Underwood, Luke Bryan, Eric Church, Luke Combs and Tim McGraw.
Winners of di award
Entertainer of di Year: Thomas Rhett and Carrie Underwood (tie)
Male Artist of di Year: Luke Combs
Female Artist of di Year: Maren Morris
End of Di one wey oda users dey read well well
Group of di Year: Old Dominion
Album of di Year: "What You See Is What You Get" - Luke Combs
Single of di Year: "God's Country" - Blake Shelton
Duo of di Year: Dan + Shay
Song of di Year: "One Man Band" - Old Dominion
New Female Artist of di Year: Tenille Townes
New Male Artist of di Year: Riley Green
Video of di Year: "Remember You Young" - Thomas Rhett
Songwriter of di Year: Hillary Lindsey, "Fooled Around and Fell in Love"
Music event of di year: Tenille Townes, Caylee Hammack & Elle King