Nations League: Ronaldo go start as Sterling, Martial, Eriksen dey in action for group matches

Wia dis foto come from, Getty Images/Reuters
Manager Gareth Southgate say England fit play wit back three defenders on Tuesday wen dem face Denmark in dia second Nations League match.
Liverpool defender Trent Alexander-Arnold dey expected to replace Kyle Walker wey dey on suspension, as e collect red card on Saturday 1-0 win over Iceland.
Arsenal strongman Ainsley Maitland-Niles go also dey in action for di Three Lions.
Raheem Sterling stoppage-time penalty na im gave England victory for Reykjavik on Saturday.
Denmark wey England go play on 8 September bin lose dia opening match 2-0 to Belgium but Southgate say na because luck no dey Kasper Schmeichel side.
Tuesday matches
- Denmark vs England (7:45pm)
- Armenia vs Estonia (5pm)
- Georgia vs North Macedonia (5pm)
- San Marino vs Liechtenstein (7:45pm)
- Belgium vs Iceland (7:45pm)
- France vs Croatia (7:45pm)
- Sweden vs Portugal (7:45pm)
- Cyprus vs Azerbaijan (7:45pm)
- Luxembourg vs Montenegro (7:45pm)
For di Sweden vs Portugal game, di fitness of captain Cristiano Ronaldo dey in doubt, as im no follow play inside Portugal 4-1 win against Croatia. Di tori be say im get toe infection.
But im coach Fernando Santos don confam, but whether im go start tonight game no dey clear.

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile Pogba fans go miss am afta im test positive to coronavirus along wit oda team mates like Kylian Mbappe, still France get enough power for dia squad when dem take on Croatia.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis game di same game as di 2018 World Cup final match wey France win 4-2 over Croatia to carry di cup 20 years afta dia 1998 own.
Anthony Martial go look to shine, just like Antonie Griezmann - wey miss last-minute penalty against Sweden - sef go wan do.
















