Kevin Ngassam: Why arrest of dis 18-year-old weh e share 'leaked exams kweshions' di make Camerooninas vex

Drawing of Kevin Ngassam

Wia dis foto come from, Kobe Williams

Published
Read am in 2 mins

Cameroonians, footballers, artists, musicians, school pikin dem and odas di vex as Gervais Kevin Ngassam from high school for Bangante, West region of Cameroon chop short prison term as suspect, for sharing exams leakage.

2020 certificate exams for Physics and Chemistry for French system, 'Baccalaureate' for bin leak, deh change de kweshion write different exams last month.

Nalova Lyonga, secondary education ministry, weh e bi in charge, do investigate, den komot list of seven officials for exams board say deh connive for leak exams.

Deh suspend de seven officials for three months, hand dem to judicial police, den file complain against 'unkown'.

Police arrest and lock five pipo weh deh share leakage and among dem, Gervais Kevin Ngassam.

According to lawyer, Emmanuel Simh, Kevin Ngassam dey prison because deh suspect say e 'publish and share leakage for social media'.

Na judge give order for e arrest and na so e find e self for Kondengui central prison, de lawyer add.

Article 163 for Cameroon penal code consider exams fraud as crime wit one to three years in prison or pay FCFA 25,000 ($45) fine, lawyer Simh tok.

https://bbc.com.im/pidgin/tori-45500574%3C/p%3E%3C/div%3E%3Cdiv dir="ltr" class="css-1k9op6x e17x9cvu0">

https://bbc.com.im/pidgin/tori-42644881%3C/p%3E%3C/div%3E%3Cdiv dir="ltr" class="css-1k9op6x e17x9cvu0">

But de lawyers say for de kana crime for correct de suspect, Kevin Ngassam still bi free as investigate still di go on.

Kevin dey fain for kondengui, for side for young pipo, but de lawyer di regret say some old pipo di pay moni for go stay for dis area as e beta pass odas for prison.

Why Cameroonians di vex for Kevin Ngassam e case

Players for national team, laik Ngadeu Ngadui and Choupo Moting, musician, Cares Fotso, Numerica, artist Kobe Williams and odas di call on authorities for free Kevin Ngassam.

Laik dem, many Cameroonians di bring examples for pipo weh deh suspect say deh kill but deh di waka free.

Among de examples, na divisional officer for Kribi, weh woman die for e room from gunshot and e no dey for prison.

Kontri pipo no di understand how, authorities go only suspend de officials for exams board for wusai de kweshions komot, but lock pikin weh e share leakage for social media.

Free Kevin Ngassam na de new campaign weh e di go round for social media.