You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Afcon trophy: How Egypt African Cup of Nation trophy take miss-Dis na wetin we know
Published
Di Egyptian Football Association dey investigate how dia trophy for Africa Cup of Nations take loss.
Dem discover say e dey miss during one work wey dem dey do for one small museum for di association headquarters for Cairo.
Egypt don win di Africa Cup of Nations three times back to back - for 2006, 2008 and 2010
Na afta di 2010 win dem give dem di right to keep di trophy for good.
Fans wey dey vex bin enta di building for 2013, but e no dey clear if na dat time di trophy bin don disappear.