How police shoot 19 year old boy wey 'impregnate im girlfriend'

Rivers State police don confam tori say one of dia men na im shoot 19 year old Ledisi Giadom wey dey face allegation say im impregnate e girlfriend.
Ledisi don undergo major surgery for im left leg for Military Hospital Port Harcourt, afta Police from Kpor Police Station for Gokana local goment shoot am for leg.
Ledisi Giadom Kote wey be fisherman tell BBC Pidgin say na on Friday 14 August, 2020 wen im dey im room for im papa house for K-Dere community na im some Policemen burst into dia compound begin look for am. One of dem come see am for im room drag am come out and shoot am for leg.
"Dem no even tell me wetin I do. Di policeman after im shoot my leg come tell me to waka follow dem, I tell am say I no fit use my leg so dem drag me enta dia motor carry me go di Police Station for Kpor.
Wen di DPO see me, im come tell dem to carry me go hospital. Dem carry me go one private hospital come give di doctor N10,000 to treat me den comot."
Na im sister wey report di matter to Human Rights Activists wey dem come bring Ledisi come Port Harcourt, report di matter for di State Criminal Investigation Department SCID, den carry am go Military Hospital for proper treatment.
Di girlfriend really dey pregnant?
Ledisi explain give BBC Pidgin say im girlfriend Avali bin tell am say she dey pregnant come ask am to give her money to abort di belle.
"I tell her say no problem but for my family, we no dey do abortion but make she come make we go do pregnancy test to confam say true true she get belle, because some girls dey take belle lie to collect money from dia boyfriends. I no see her again only for her to come with di police dat Friday wey di police shoot me for leg."
End of Di one wey oda users dey read well well
'I want justice'

Ledisi dey demand justice for wetin happen to am as im never see im girlfriend, Avali since di incident happen or her family and di x-ray show say di bone for im left leg wey dem shoot shatter, and im no go fit continue wit im fishing business or use di leg well as e be now.
"Dis operation wey I go do naim go determine how di next step but for now I no fit do anytin. I want justice." Im tok.
Rivers State police tok tok pesin Nnamdi Omoni add say di State CID dey investigate di matter.













