Coronavirus: Ghana hospital workers wey dey sell PPE for dia personal gain unmasked

Wetin we call dis Video, Ghana hospital workers wey dey sell PPE for dia personal gain
Published

One Africa Eye undercover investigation don show say some staff for Ghana hospitals dey sell Personal Protective Equipment (PPE) for dia personal profit.

More dan 2,000 medical workers for Ghana don catch coronavirus since di outbreak begin. Di kontri don see serious scarcity of essential protective equipment like face shields, masks and suits.

Di investigation show how some medical workers dey make profit at di expense of dia colleagues.