EFCC Chairman Ibrahim Magu wey chop suspension for allegation of corruption don comot from detention on bail

Ibrahim Magu

Wia dis foto come from, EFCC/Twitter

Published

Ibrahim Magu wey chop suspension sake of for allegation of corruption as head of Nigeria corruption police- EFCC don comot for detention afta more than a week for detention.

Magu, di suspended acting chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC get release from detention on bail on Wednesday evening.

A team of security pipo from Nigeria secret police - di Department of State Services, di Force Criminal investigation department (from Nigeria police department) bin arrest Magu to appear before Justice Ayo Salami presidential panel wey di investigate di anti-graft agency during im tenure.

Since den, Magu don dey detention for di Force Criminal Department for Abuja wia e dey go to go ansa question from di panel.

Di suspended acting Chairman of the Economic and Financial Crimes Commission bin spend 10 days in police custody.Magu nta arrest on 6 July, 2020 ontop allegation say e no fit account for di interest wey enta ontop recovered funds of about N550bn.