Lazarus Chakwera: Malawi President rise from being a pastor, opposition leader to di new man in charge of di East African kontri - Dis na who im be

Published

Lazarus Chakwera take oath of office alias swear in on Sunday morning as di President of Malawi afta e win historic election.

Chakwera wey be Malawi opposition leader until last night, win di kontri rerun presidential vote.

According to di electoral commission on Saturday, e defeat sitting president Peter Mutharika with 58.57% of di vote for Tuesday election.

Na for February, Malawi constitutional court cancel di May 2019 election wey oga Mutharika win say e bin get vote tampering.

Di kontri bin get serious kasala before last Tuesday election.

As dem announce di result, oga Chakwera call im victory say, "na win for democracy and justice" even as dem be di second African kontri (afta Kenya) wey go cancel presidential election on top wuruwuru alias vote rigging.

Who be Laxarus Chakwera?

Lazarus Chakwera na opposition leader and former pastor wey dey also lead di opposition Malawi Congress Party (MCP).

Dem born am for 5 April, 1955 to papa wey be subsistence farmer.

From dat background, na im e take study Theology for Malawi, South Africa and America.

E also work as pastor and lecturer for di Assemblies of God School of Theology.

Dis no go be di first time im dey run for office of president, e run for 2014 and come second.

Oga Chakwera na di leader of s nine party coalition wey call demself, di Tonse Alliance and bin get backing from Malawi former presido Joyce Banda and di kontri vice presido Saulos Chillma wey be im running mate.