You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kara bridge explosion: Authorities identify deadibody inside ashes of di tankers wey explode around Berger
Di Lagos state emergency management agency, Lasema, say dem don identify deadibody inside di ashes of di tankers wey explode ontop Kara bridge around Berger for Lagos, south west Nigeria on Saturday night, 20 June, 2020.
According to tori, one gas and petrol tankers wey curfew lockdown hook for Kara bridge catch fire afta dem explode.
Lasema wey confam say firefighters don quench di fire say na four tankers bin involve for di incident and na reckless driving cause am.
According to Lasema, na one truck wey carry 33,000litres of premium motor spirit crash enta anoda truck wey dey drive enta Lagos Ibadan Expressway.
Di impact of di crash na im cause di fire.
Di driver of di gas tanker Yusuf Tiamiyu tell BBC Ajoke Ulohotse say, im bin dey inside im motor dey wait for curfew to over before di incident happun.
"I say make I go sleep for tractor wey I dey always sleep, na im one petrol tanker wey fail brake dey come hit us. My tanker and di petrol tanker dey fully loaded."
"If not for dis lockdown dis wan no for happun, di money we lose plenti." Tiamiyu tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Lasema oga Olufemi Oke-Osanyintolu say, dem never fit confam yet how many pipo die inside di fire.
For June 2018, about nine pipo die and 54 motor burn for anoda similar tanker explosion wey happen for Lagos-Ibadan express way.
See more pictures from the incident.