Anglophone crisis: 'Three men rape me, I no know di papa of my pikin'

Wetin we call dis Video, Di rape don scata my dream
Published

Catherine, 19, bin get big dreams for work for office laik director, but dat dream don scatter because of rape last year.

Today Catherine weh e run kam Yaoundé no know wusai e papa and mami dey.

Human Rights Watch don report rape for Anglophone crisis and how de victims di fear for report.

UN systems representative in Cameroon, Allegra Baiocchi for December last year tok how e bi important for protect woman and girl pikin dem.

Anglophone crisis start for 2016 den turn to fight between goment and separatists forces, 500,000 pipo do run go oda areas, 600,000 and more dan 3000 pipo don die.

Norwegian Refugee Council don say dis Anglophone crisis na one of the top ten crisis for de whole world and Sub-Saharan Africa.

Story: Bongben Jisi