Lockdown extension in Nigeria: President Buhari extend gradual easing down for anoda two weeks - Wetin you need to know

Wia dis foto come from, Nigeria Govt
Nigeria don extend di ease of di lockdown for di kontri for additional two weeks to fight coronavirus.
Na wetin di Chairman of di taskforce Boss Mustapha tok as im address tori pipo on Monday for Abuja.
Oga Mustapha say tins go remain as dem dey for now and dis one go start from Midnight 18 May to June 1 2020.
Dis one mean say church, mosque and schools for across di kontri go still dey closed.
But for Kano state for north west Nigeria di existing lockdown order go continue for anoda two weeks.
Nigeria get 5959 confirmed cases of coronavirus and 182 don die while 1594 don recover from di disease as May 17 according to di Kontri centre for disease control
Na Lagos get di highest number of Covid-19 cases for di kontri with 2550 cases.
Wetin di PTF Taskforce oga tok?
Oga Mustapha say:
End of Di one wey oda users dey read well well
- Kano lockdown go continue for anoda two weeks.
- Dem don review di level of compliance and dem direct security agencies to make sure say pipo obey di guidelines of di nationwide curfew wey go continue from 8.00pm to 6.00am; di ban on interstate travels and wearing of facemasks/covering for public go still remain.
- President Muhammadu Buhari don direct di Presidential Task Force on Covid-19 to "work closely wit all state govnors" for di kontri.
- Di PTF go increase dia efforts to "tok (communicate), trace (identify) and treat (manage)' cases;
Wetin be di result dem get during di last two weeks relax lockdown?
Di taskforce oga, Boss Mustapha, say na mixed results dem see afta dem relax di lockdown two weeks ago. Im say "we meet some of our objectives, but wetin we notice na say many pipo no follow di guidelines ," na wetin Boss Mustapha tok
Dis na some of di tins wey dem achieve.
- Di number of laboratories for di kontri for Covid-19 don increase from 15 to 26.
- Dem don carry out additional 15,558 tests (di total number now na 35,098 and di number of tests per million don increase from 50 to 154.
- Increase in di number of trained personnel.
- Procurement and distribution of additional PPES.
- Di doubling time of coronavirus don slow down from seven to 11 days.
- Di number of beds available for isolation and case management increase from 3,500 to 5000 beds nationwide.
- Efficiency of identification, testing, evacuation and isolation process for confirmed cases don increase.
- Progressive improvement of capacity of health system to respond to di outbreak.












