Trump in India: Wetin di American president find go di kontri

US President Donald Trump don address public rally for India in front of PM Narendra Modi and 100,000 pipo on im first official visit to di kontri.
Come see plenty clap-clap wen e start wit "Namaste," before im go kontinu to tok about ogbonge Indian pipo from cricket to history to Bollywood.
Im bin dey tok for Motera stadium for Gujarat, wia oga Modi hail from.
Oga Trump visit go focus on how di two kontris fit ginger dia relationship pass how e be now.

Wia dis foto come from, Getty Images
"India go always get special place inside our hearts," im tok.
Trump also praise Modi: " Everibodi love am but make I tell una something, im dey very tough. You no just be di pride of Gujarat, you be living proof say wit hard work, Indian pipo fit do anything dem want."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Di American 45th presido end im speech wit "God bless India, God bless di United States of America - we love you, we love you very much."
Billboards wey get foto of di two men full di road wia Trump go pass wit slogans like "two dynamic personalities, one momentous occasion".
End of Di one wey oda users dey read well well

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

Before e enta stadium for di rally, Trump and im wife branch di Sabarmati Ashram, wia Indian independence leader Mahatma Gandhi, wey hail from Gujarat, bin live for 13 years.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Getty Images