Jesus Baptism make Orthodox Christians chook body inside water wit ice block

One woman dip inside water for di Orthodox Epiphany in Omsk

Wia dis foto come from, Reuters

Published

E don tey wey worshippers across Russia and Eastern Europe go enta cold water wey dey freezer, to take mark wen Jesus baptize inside River Jordan.

And dis event na one of holidays wey important pass for di Orthodox Christian calendar.

Every 19 January, Epiphany na di remembrance of di baptism of Jesus inside River Jordan.

Presentational white space
Priest conduct Epiphany ceremony wit worshipper

Wia dis foto come from, Reuters

Presentational white space

To mark di event many Orthodox Christians go soak demsef inside cold water dey don nearly turn to block. Dem fit dip demsef inside three time to take honour di Holy Trinity.

Presentational white space
One Orthodox priest dey bless di water for Svyatoye, wey dey outskirts of Russia capital, Moscow

Wia dis foto come from, AFP

Presentational white space

Dem believe say di tradition dey bring good health to worshippers and dey wash dia sins comot. Above, one Orthodox priest dey bless di water for Svyatoye, wey dey outskirts of Russia capital, Moscow.

Presentational white space
Wetin we call dis Video, See how organisers for Russia dey prepare di hole wey go carri di freezing water
Presentational white space

Worshippers believe say all water dey turn to holy water on Epiphany. Some also tink say di freezing water dey good for di health.

Presentational white space
One man enta cold water for lake

Wia dis foto come from, Reuters

Presentational white space
Serbia Orthodox Christians jump into di cold water of di Sava river for Belgrade

Wia dis foto come from, AFP

Presentational white space

For Serbia Orthodox worshippers jump inside di cold water of di Sava river in Belgrade.

Presentational white space
Vladimir Putin inside cold water

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, And who fit forget Russia presido Vladimir Putin wen e do im own Epiphany celebration for 2018
Presentational white space

For dis picture, one woman just comot from inside water for di Russia city of Omsk, wia temperatures don drop to below -10C (14F).

Presentational white space
One inmate soak imsef for high-security prison Omsk, Russia

Wia dis foto come from, Reuters

Presentational white space

Dis prison guards dey monitor inmates as dem enta di hole for ground wey get di cold water, for Omsk high-security prison.

Presentational white space
Serbian Orthodox chrsitians pose for a photo

Wia dis foto come from, AFP

Presentational white space

Worshippers pose for photo afta dem swim dia cold water swim finish for Belgrade Sava River.

All photograph dey subject to copyright.