You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Cameroon student stab teacher to death inside school'
Reports say one Cameroon form three student don kill e maths teacher for goment high school Nkolbison.
Tori be say de student 'chook de teacher two taims for chest before e run.' Just now deh don catch e and e dey for commissariat
De maths teacher die for hospital as deh rush e for emergency.Official for ministry of secondary education don confam say deh go see de die bodi for University Teaching Hospital.
Minister for secondary education, Nalova Lyonga weh e bi di go for Douala turn back for go know weti di happun.
Just now for goment high school Nkolbison, students and teachers all look sad.
Minister for Secondary Education , Nalova Lyonga hold meeting with staff
"We school and society get problem, dis student kill teacher with knife weh e bring'am from house". na wetin Nalova Lyonga
"When school discipline pikin dem some parents no di understand, deh di attack teachers sotei deh di feel laik victims. Teachers no bi victims, deh di only try for discipline dem". na wetin she add put
End of Di one wey oda users dey read well well
Minister say for now, investigate di go on for really know de problem weh de teacher bin get wit student sotei e chuck e wit knife.