Doctors for Ghana say dem go proceed on strike next week

Nurse walks in front of an accident centre
Published
Read am in 1 mins

Doctors for Ghana threaten say dem go withdraw dema services in one week if goment no deliver conditions of service give dema members.

De Ghana Medical Association (GMA) for dema official notice inside say starting November, 18 dem go withdraw dema services from Out Patient Department (OPD).

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

If by December 2, dem resolve dema issues Ghana doctors go withdraw all emergency services, then by December 9, dem go withdraw all services totally.

Around September 2015, Government of Ghana den de GMA sign document on dema conditions of service.

National President of GMA, Dr Frank Akobea, govment say govment no honour dema pledge since dem enter de agreement that be why dem take dis decision.