BBC Pidgin Essay Competition: Meet Ikechuckwu Wilson wey win di 2019 edition

Ikechukwu Wilson winner of BBC Pidgin Essay Competition
Published

Ikechukwu Wilson Nweke na im be di winner of di 2019 edition of di BBC Pidgin Essay Competition.

Ikechukwu na 200 Level student of University of Benin wia im dey study International Studies and Diplomacy.

For ceremony wey happun for Lagos, Nigeria wia BBC Pidgin announce am as winner, im read di essay wey see am beat oda pipo wey submit dia entries.

Ikechukwu title im winning essay 'Africa dey ready for female political leadership.'

According to Ikechukwu, di essay wey im write na "to support equality."

"I dey happy to win di competition becos wen I bin write dis esaay I bin no dey feel fine," na so Ikechukwu tok

Dis na di second time BBC News Pidgin dey arrange dis essay competition wey dem wan continue to dey do evri year.

line

See di entry wey see Ikechukwu win

"Africa dey ready for female political leadership."

Leadaship wahala na wetin wey dey chop Africa kontinent as food.Africa na wan of di seven kontinent wey dey di world wey get rich cultures, resources and different pipo (ethnics) but afta e kontries get independence from di hands of di oyibo wey be rule ha afta di scramble of Africa (1884/85), leadaship wahala don make e kontries kneel down.

Sabi Pipo for political economy sey na di slave trade and colonaizeshon na e mek Africa no dey laik e mate, but di problem of Africa wey mek am no dey laik oda kontinent na poor leadership and ojoro wey dey rain foh Africa.

Since oyibo kontries begin dey knack African kontries independence well well wey first start wit Liberia (1847). Since den, na onli few

women don rule Africa.Naturally , pipo be dey see women as weaka genda wey go end in Kitchen bekos of dis , women kom be pipo wey dem leave foh back wen e kom foh politics mata.But several women don raiz to challenge di press press wey men be dey press dem. Di hai success wey women get foh leadaship in di world and Africa don mek Africans ready.Even Muslim kontries wey e dey dey hard foh woman to smell pawa don dey sopot dem well well.Di reason wey mek dem ready na bekos of doz wey don rule and literacy wey don hai foh Africa.Literacy don mek Africans see men leadership as scam and di raiz of Feminism follo helep dey ginga equality foh everi kona of life and anoda tin wey mek dem ready na di beta record foh leadaship wey di Few female formal African president get .

From meni tins wey women dey do foh Africa and how Africans tek dey back dem up , no need again to doubt sey "Africans dey ready foh Female political leadership" . In taims of world politics meni women from Africa get mouth , pipo laik Amina J Mohammed wey be Deputy Secretary General foh United Nations, , Ameenah Fakim wey be wan taim Mauritius president, Elisabeth Dominiten wey be first female prime minister foh Africa and Alhan Olmar wey dey play weight foh world politics, di success and change wey dem bring mek pipo dey change how dem be dey see women befoh.

Meni kontries don dey clear road foh women leadership, kontries wey dey laik Tanzania get special seats foh women foh dia Parliament , no bodi dey drag am from dem .Dis kain tin dey ginga women to join gofment , wit dis we go know sey some African kontries don lay foundation or ready foh female leadership.

Foh som Muslim kontries befoh , women no too dey politics bet di raiz of Alaa Salah of Sudan wey lead di Sudan protest go show pesin how pipo dey ready to trowey di old believe sey woman no fit rule.

If pesin chook eye foh wetin wey happun foh Sudan dis year , di pesin go know sey na woman na e lead di protest wey commot di long taim tyrant Sudan presido and meni Sudanese sopot am wich means dia need a rula who dey ready to rule even if na woman.Wetin wey go dey boda pipo na mek di pawa no kom dey wan sai-d again bekos by eye chook , pesin go see wetin wey dey happun foh Algieria wia 70 % income earnas na women , di majority lawyas na dem , though dem neva di rule but dis go show pipo di sopot dem dey get and di weight dem dey kari. Di most prominent African pesins today na women, wich go tell us more about dey kain ogbonge spirit wey dem get and na dat dia ogbonge spirit na e mek Africans wan welcome dem.

women sabi cool down more dan men , dis go mek dem sofri dey handle palava wey dem get insai-d and awsai-d dia kontries.Africa wey dey face migration , Ojoro and poverty, kari eye dey fain who go mek doz tins kpai witout lookin at uche face.Dem dey ready to vote di pesin weda na female or enitin, so fa di pesin go bring change kom.

African women rait from histori don get lioness spirit Wey mek dem rule dia kingdom in dey odin days wen oyibo neva kom Africa.Befoh di colonaizeshon of Africa, Africa don already get pawaful women wey sabi rule, if todays African women fit rule laik doz women "African histori go change" .Pipo laik Queen Amina wey rule Hausa pipo, Queen Cleopatra of classical antiquity Egypt , mulatto solitude of

Ashanti kingdom and Queen Sheba of Axum , dis women get pawa foh dia taim wey mek dem rule dia kingdom.

So , African women rait from taim don sabi rule but di komin of Oyibo pipo kom stop all dis tins, kom kari pawa put am foh men hands and dem kom dey abuse am.

Since African kontries begin dey get independence wey start from Liberia (1847), and Ethiopia wey dem no colonaiz, Men be di rule .Di poor performance of di men leadaship na e mek Africa undadevelop, na e mek ha economy down , poverty,high death rate , low per capita and hai illiteracy all dis na wetin e cause.Di Men leadas dey thief dia kontries moni kari am go keep foh oyibo kontries instead dem go use am develop dia own kontri. Dis ojoro palava na e men use underdevelop Africa.Foh a kontri to develop e go get stable politics and economy wich African leadas no gree give dia citizens since independence wey dem begin to knack African kontries well well since 1960.

Since di male politicians no gree do good , meni women don kom to teach dem how to do am and Africans don taya to dey criticise dia male politician wey las las go be laik tree wey no get fruit.Di main reason wey mek Africans popori finish dey wait foh who go kari dem along na di poverti wey men politicians kos , di thief thief , human rait abuse and oda women wey don rule Africa and di won wey dey rule oyibo wey do somtin foh dia pipo , all dis mek Africans dey ready to wekom Women .

Di raiz of feminism and equality and di cry of Africans foh betament don clear road foh di komin of meni pawaful women wey dem taste and

believe sey dem good. Equality na wetin dey rain foh di world and e don enta Africa, and as a continent wey won bury poverty and Ojoro e go mek sense mek everibodi dey equal in evritin no mata di pesin genda , na dis fit helep di kata kata wey dey wahala pipo upandan foh Africa.

E no dey fashonable again to sey women na kitchen dem dey end bekos from di wans wey we don taste , five stars na e dem collect.Africa don grow finish so women fit rule and since Africa begin dey grab independence well well na onli few women don rule but meni don hold wan or two post foh dia different kontries wich dem do well.Pipo laik Ellen sirleaf wey bring peace to Liberia and Ngozi Okonji Iweala wey mek Nigeria di best economy foh Africa and fastest growing economy in di world foh her taim go tell us how e go be if women get chance to siddon foh di presido sit.

To jos chook eye pesin go know sey di kontries wey women be don rule no get kata kata again or hungry wey be dey knack dem upandan don dey fain wey, dis tins mek Africans dey ready to sopot women leadership. If pesin chook eye foh wetin wey happun foh Suddan di pesin go rememba sey na woman wey lead di pipo wey commot dia tyrant leader no be onli dat , Mauritus na wan of di best kontri in Africa since Ameenah Gurik Fakim start to dey rule am.She kuku clear ojoro befoh she commot and mek her kontri wan of di best, from dis we go know sey Africa don ready to elect women bekos no pesin go see road and won waka enta bush.

Africans know sey e no dey fashonable again to sey women no fit rule na e mek dem dey sopot women upandan.Plenti women neva rule African kontries bet di few wans wey don rule beta pass dia men

counterpart. Africans see women to be more economaizin and less koropt and na from di little wans wey don rule na e dem tek know.Africans no go eva tok mek dem no menshon Ellen Sirleaf wey bring peace foh Liberia , Ameenah Fakim of Mauritius , Amina J mohammed wey be Deputy Secretary General of United Nations (UN) and Ngozi Okonji Iweala of Nigeria , all dis women helep dia kontries in wan way or di oda.Since di male leaders no gree solve di kata kata wey dey wahala Africa , dis women kuku do di tin wey dem no fit do.

Africans dey see wetin wey dey happun foh oda oyibo kontries wey som don rule dem, dem dey see how Angel Merkel dey transform Germany and na woman she be and di ojoro wey awa male politicians don do foh meni years , all dis tins don mek dem ready for female leadership.