Climate change: Nigerian, 15 oda young pipo file complain against five world economies

Deborah Adegbile and Ayakha Melithafa

Wia dis foto come from, Children Vs Climate Crisis

Wetin we call dis foto, 12-year-old Nigerian Deborah Adegbile, and 17-year-old Ayakha Melithafa from South Africa na two of di African wey follow lay di complain
Published
Read am in 2 mins

Sixteen young climate activists on Monday file complain with di United Nations, point finger say five of di world major economies don violate dia human rights sake of say dem no do enough to stop di climate crisis.

12-year-old Nigerian Deborah Adegbile, 17-year-old Raslene Joubali from Tunisia and 17-year-old Ayakha Melithafa from South Africa na di three Africans wey follow lay di complain.

Dem file di complain small time afta ogbonge activist from Sweden Greta Thunberg change am for world leaders with her speech for di UN Climate Action Summit wey happun for New York , America.

Di young activists for di press conference on Monday wia dem present dia complain.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di young activists for di press conference on Monday wia dem present dia complain.

Di petition accuse five kontries, Germany, France, Brazil, Argentina and Turkey wey dem say don fail to do dia part under di Convention on di Rights of di Child. One 30-year-old human rights agreement wey be di one kontries don sign pass and wey dey valid well-well throughout history.

Press conference wia di 16 children present dia complain

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Press conference wia di 16 children present dia complain

Dis action dey come as UN host Climate Action Summit on di first day of di General Assembly wia plenti leaders tok about dia plans to reduce dia kontri carbon footprint.

For press conference di children hold near wia di summit dey happun, Thunberg and di oda children express dia frustration say world leaders too slow to fight climate change.

"Di message wey we wan send na say enough is enough," Thunberg tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Last week, di 16-year-old Swedish climate activist Thunberg lead children dem and adults from 150 kontries for ogbonge climate strike on Friday say di world no dey do enough to fight climate change.

Adegbile wey dey live for Lagos, Nigeria say she begin to dey advocate for change afta she see di way climate change dey cause palava. She say rain wey bin dey fall from April to September now don extend to December.

Pesin carry placard wey say listen to Greta

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Last week, di 16-year-old Swedish climate activist Thunberg lead children dem and adults from 150 kontries for ogbonge climate strike

Every time rain fall now for Lagos, flood dey happun and her parents must carry her and her younger ones go school because dem no fit waka inside di deep water.

Adegbile dey also advocate to protect di ocean through plastic reduction as she don take eye see how e dey affect di ocean and animals off di coast for Lagos.

Dis action dey come as report come out say di sign and impact of global warming dey happun fast- fast and 2014 to 2019 na di hottest for record.