Lagos election result: Tinubu dey sure of APC win

Wia dis foto come from, STEFAN HEUNIS
Election bodi Independent National Electoral Commission don begin announce results for different state wia govnorship election happun.
Nigeria commercial capital Lagos na one state wey pipo out eye for dia result wella.
You fit see as voters take vote if you click hia: Link
Bola Tinubu wey be di national leader of di All Progressives Congress, say di party dey sure say dem go win di govnorship election for Lagos State.
Di former govnor of di state wey follow tori pipo yan afta e vote of Saturday, say "Lagos no be Kwara na," as im ansa kweshun onto di 'Otoge' movement wey shake Kwara State for presidential and national assembly elections.
"Na we be di only party for Lagos, di rest na repeater station. Dem dey come out evri four years and go back like crabs.
"Di state belong to di progressives, we be progressives and we go win dis election," im tok.
APC candidate for Lagos State na Babajide Sanwo-Olu and im main challenger na Jimi Agbaje wey be di candidate of di PDP.
End of Di one wey oda users dey read well well
Na on Sunday election bodi INEC go open di collation centre for Lagos, wia dem go begin announce result.












