‘Deh don catch army weh e force pikin dem for immoral dance for Bamenda’-Northwest governor

Northwest governor, Adolphe Lele L'Afrique say deh don catch army man weh e force school pikin dem for some kana immoral dance for inside dormitory for video for Northwest region.
"Deh don identify, catch and punish soldier we e make video for de pikin dem for video putam for social media", Governor write.
Lele L'Afrique no tok de kana punishment weh deh givam for dis army make weh e di point e gun for pikin dem as deh di dance wan kana immoral dance.
But governor quickly add say de incident weh na just one no spoil image for soldiers weh deh di ensure security for pipo and dia cargo for Northwest region.
For one school for Northwest region, soldier man weh deh send'am for go guard school, gada pikin dem for inside one room, den ask dem for dance some kana immoral dance.
As deh pikin dem di dance e di watch, di laugh even if e face no di show for de video, deh di see as e point e gun for de pikin dem as deh di dance.
Den de school no bi gree for comment and na afta weh governor komot press release say deh don punish de army.










