Roger Milla, oda Cameroon 1990 teammates receive President Biya e house gift afta 30 years
Published
Some player for Cameroon Indomitable Lions squad weh e put de kontri for world stage, say de take note say de messenger weh de send wit dia gift no deliver 30 years ago.
President Paul Biya weh e watch de Lions for Italy as deh reach quarter finals for 1990, de highest level any African team don eva reach, bin promise de team houses for dia wonderful performance.
But de minister for dat taim bin add more pipo for de list and de whole process develop k-leg.
As de players get dia houses, de coaches weh deh take dem for dat world cup journey nova get dia own houses.
Michel Kaham, Jules Nyongha and Jean Manga Onguene, assistant coaches for Valery Nepomniachi de head coach for dat taim, di still make president Biya give dia own houses.
