Serena Williams: Di ‘never give up spirit’ of di ogbonge tennis player

    • Author, Fiona Equere
    • Role, BBC News Pidgin
  • Published

"I no go fit continue to play like dat" dis na wetin Seven time champion Serena Williams tok afta she crash comot from Australian Open on Friday morning and lose 6-4 6-7 (2-7) 7-5 to Wang Qiang from China for third round.

"I no fit play like dat. I literally no fit do dat again. E dey unprofessional. E no dey cool." Senera tok

As e be so Serena search for her 24th grand slam title go continue.

Wang bin dey serve for di match when di game dey 5-4 but Williams broke her for di first time come win di tie-break to level di game.

Di 28 year old Wang wey be number 27th seed for world tennis ranking, recover come seal victory for her third match point.

Wen tori pipo ask Serena wetin she think afta di game, she say

"I honestly no think say I go lose datat match."

She add say "I just make far too many errors to be professional athlete today."

Tori be say dis Friday defeat na Serena earliest exit for Australian Open since 2006, when she lose for dis stage to Daniela Hantuchova.

Dis na Williams 23rd year as professional tennis player and she still dey eye Margaret Court record of 24 grand slam singles titles.

Di last time wey 38 year old Serena win grand slam na 2017 when she beat her sister for Australian Open final to win her 23rd title and na di same year she born her daughter too.

See di number of times wey Serena don try to break Margaret Court record