Sowore in detention: Heavy security as two groups protest for Abuja

Published

Heavy security dey ground for Unity Fountain Abuja, Nigeria on Wednesday wia two groups do I-no-go-gree for di kontri capital.

Di Concerned Nigerians group dey demand di release of journalists and writers wey authorities detain for Nigeria, including di leader of di RevolutionNow protests and former presidential candidate of di African Action Congress (AAC) Omoyele Sowore.

Meanwhile di oda group, di Guardians of Democracy and Development dey protest against di Taraba killings and katakata between di Tiv and Jukuns wey don displace hundreds of pipo.

Tok-tok pesin for di Department for State Services, Peter Afunaya, bin tell BBC say dem arrest di organiser of di protests wey dem call 'Revolution Now' on Saturday morning because im dey call for di overthrow of Nigerian goment.

Sowore remain for DSS hand afta court grand dem leave to keep am for 45 days.

Before di protesters show for Unity Fountain, a combined team of security personnel bin show inside nearly ten trucks to maintain peace and order, but di protesters say dem no dey fear security bullet and dat dem go kontinu to come out to demand for di release of Sowore.