Kemi Remi Dairo: 'Noise from loudspeaker almost make me go deaf'
Published
Kemi Remi Dairo bin go party and wen she reach house na im she notice say she no dey hear again.
She follow BBC Yoruba tok say di noise wey dey comot for speaker loud and e affect her ears but she bin no know say e go bad reach to soil her ear.
She say her pikin na im dey write wetin dem wan tell am for her to read and her husband dey use text message.
She go through surgery and start to dey use hearing aid to prevent herself from going completely deaf.
