Chale Wote 2019: Wetin be Pidgin Imaginarium?

Wetin we call dis Video, Chale Wote 2019
Published

For di past nine years, chale wote don gada shoulder as one of di biggest street art festival for West Africa.

Di mata wey dey shele for Jamestown, Accra, Ghana dey pull plenti pipo from all over di world to follow as di mata dey go.

Part of di production team follow BBC Pidgin tori pesin Abdulmalik Fahd gist on why dem name dis year theme for di show 'Pidgin Imaginarium'.

Producer: Abdulmalik Fahd

Asst Producer: Usifo Omozokpea

Fotos: Favour Nunoo

Filming: Ufuoma Gift