Delta state election result update: Ndokwa East LGA
Registered voters: 86,208
Accredited voters: 20,434
APC: 9,044
APGA: 120
LP: 251
PDP: 10,146
Valid votes: 19,843
Rejected votes: 485
Total vote cast : 20,328
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Inec dey announce results for di govnorship elections for 28 states and State House of Assemblies for 36 states for Nigeria.
Helen Oyibo and Victor Ezeama
Registered voters: 86,208
Accredited voters: 20,434
APC: 9,044
APGA: 120
LP: 251
PDP: 10,146
Valid votes: 19,843
Rejected votes: 485
Total vote cast : 20,328
Registered voters: 57929
Accredited voters: 20654
A: 1,885
APC: 7,014
LP: 10
PDP:. 11,125
Valid votes: 20377
Rejected votes: 275
Total vote cast : 20652
Everytin don set for Lagos state to begin call di govnorship election result.
Registered voters: 47621
Accredited voters: 17045
A: 50
APC: 5,570
LP: 17
PDP: 10,930
Valid votes: 16778
Rejected votes: 267
Total vote cast : 17045
Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC don tok say dem arrest more dan 65 pesins for Saturday March 18, 2023 across di 28 states wia govnorship and state Houses of Assembly elections happun, for allege vote buying.
Operatives of di commission wey dey election duty for different locations arrest 20 pipo for Ilorin, 13 for Kaduna,12 pipo for Port, Harcourt, Zonal commands wen dem dey try make pipo to vote for dia own candidate in exchange for moni.
EFCC also gbab four pipo for Calabar, Uyo Zonal Command and di remaining for Gombe, Sokoto, Kebbi and Niger states.
"During interrogation, some of di suspects identify demselves as party agents while some admit say dem dey share moni to induce voters" EFCC tok for statement.
Everytin don set for Rivers state collation centre wia Inec wan begin dey call di results.
Registered voters: 45437
Accredited voters: 15003
A: 2,066
APC: 4,597
LP: 09
PDP: 8,034
Valid votes: 14839
Rejected votes: 162
Total vote cast : 15001
Collation of results don dey shifted to 2:00pm for Kano and Kaduna states.
Meanwhile, Akwa Ibom, Delta and Oyo states dey collate at di moment.
Registered voters: 72523
Accredited voters: 25676
APC: 8,882
LP: 173
PDP: 15,554
Valid votes: 25248
Rejected votes: 438
Total vote cast : 25,676
Voting don start for Victoria Garden City, Lagos state.
Yesterday voting bin no shelle sake of electorates bin complain say di Inec adhoc staff set up outside di estate and say make dem come outside come vote.
Di electorate say dem no gree as dem insist say na inside di estate dem go vote as dem don do for many years.
Meanwhile, na eight polling units wia dem register dey inside di estate and dem bin insist say dem no go cast dia vote outside di estate.
Registered voters: 131945
Accredited voters: 34807
APC: 4,733
APGA: 46
LP: 1990
PDP: 26,760
Valid votes: 33,807
Rejected votes: 918
Total vote cast : 34725
Collation and announcement of govnorship election results by Inec don start for Delta state.
Election don dey hold for VGC Lagos today afta polling officers refuse yesterday to enta di estate wia dem dey always do election, say make di pipo come outside.
Security pipo dey for ground dey monitor tins. #governorshipelection2023
Collation of govnorship election results by Inec don start for Oyo state.
Di Returning officer don read out di instructions.
Meanwhile, no be only for Rivers state Inec reschedule elections.
Victoria Garden City for Lagos be one of di places wey election go hold.
Di issue for dia be say for early Saturday, electorates bin complain say di Inec adhoc staff set up outside di estate and say make dem come outside come vote.
Di electorate say dem no gree as dem insist say na inside di estate dem go vote as dem don do for many years.
Di Independent National Electoral Commission, Inec go conduct election wey dem suspend for Asari Toru local goment and Ward 14 for Degema LGA today, Sunday 19 March 2023 for Rivers State.
For statement wey di Resident Electoral commissioner, Rivers State Dr. Johnson Alalibo Sinikiem sign, im say di govnorship and State Assembly election no hold for Asari Toru LGA becos voters and oda stakeholders resist deployment of election officials and materials as dem insist say Ward collation officers must dey ground before any election go start.
Di statement add say for Ward 14 Degema LGA, voters demand say di supervising Presiding officer SPO must come to di RAC center with election result sheets before any election go hold, but explain say dat na di responsibility of di collation officer.
Dr Johnson Sinikiem say relying on section 24 of di Electoral Act 2022, di commission decide to suspend and conduct di election on Sunday 19 March 2023 for Asari Toru and Ward 14 Degema LGAs.
Meanwhile, collation and announcement of results for di govnorship elections from di local goment areas go begin by 10:00am for Inec Headquarters Port Harcourt.
Di Independent National Electoral Commission, Inec, go begin collation of election result on Sunday.
Gubernatorial and States House of Assembly elections hold across 28 states of di federation on Saturday March 18.
Di election bin come wit reports of violence and suppression for some states like Kano, Rivers, Lagos, Bayelsa among odas.
BBC Pidgin see reports of violent attacks, scattering of ballot box and delays wey happun for di elections, we also see online reports of attack on di media, security operatives wit claims say some pipo lose dia lives and odas injure sake of di kasala.
Presidential candidate of di opposition Labour Pary , Peter Obi for one tweet condole wit di families of pipo wey lose dia lives during di election.
Di katakata make INEC postpone election for some parts of di kontri till Sunday.
Some of di places wey dey affected be VGC for Lagos, and some parts of two local goment for Rivers state. Election go hold for dis places on Sunday
Reports of voter apathy na also one of di general issues wey happun for di election. Observers tell BBC Pidgin say dem experience low voter turnout for some areas wey dem monitor di election.
Contrary to wetin happun during di February 25 presidential election, low turnout of voters dey for most states.
Inec dey expected to begin announce di results from Sunday as some collation centres go begin open by 9:00am.
Welcome to our live coverage of Nigeria govnorship and State House of Assembly elections.
Wia we dey now, na di stage of result collation and announcement by Inec.
Follow us here as we bring una all di updates live as we dey get dem from our reporters wey dey monitor di collation and result announcement process from across di kontri.