You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Peter Obi raise alarm of alleged planned protests by opposition in Obidients name

28 states go hold govnorship elections for Nigeria on Saturday 18, March, 2023.

Live Coverage

Victor Ezeama and Helen Oyibo

  1. Women for Port Harcourt demand peaceful governorship elections

    Women for Port Harcourt don do protest waka go INEC headquarters for Port Harcourt.

    Di Women wey wear black on black dey demand peaceful, free and fair elections for di govnorship and State House of Assembly elections wey go hold on Saturday 18 March, 2023.

  2. INEC don begin move sensitive materials to for LGAs, Di three major candidates na di candidates of di PDP, LP and APC

      • Author, Andrew Gift
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Nigeria election bodi INEC for Lagos southwest Nigeria don begin distribution of sensitive election materials for di govnorship and state house of assembly elections wey go hold on Saturday.

    Di materials dey move from di Central Bank office for Marina Lagos to various LGAs wia dem go from move am to ward levels and later polling units.

    Security full ground around di CBN Office during di distribution, but e no reach di kain security wey dey ground during di movement of materials during di presidential election.

    Di election on Saturday dey happun three weeks after di presidential election as INEC bin delay di polls by one week.

    About 16 pipo dey contest for govnor under various parties, but some don step down for odas as di day dey approach.

    Di three major candidates na di incumbent govnor Babajide Sanwo-Olu of di APC, Rhodes Viviour of di LP and Adediran Olajide Jandor of di PDP.

  3. INEC don begin distribute sensitive materials for Kano

    Independent National Electoral Commission (Inec) for Kano state don begin distribute sensitive materials wey dem go use across 44 local goments for Saturday governorship and Assembly elections.

    Just as during di Presidential Elections wey hold last month, di furthest local goment from Kano city na dem motor go first load dia own before di closest ones to di city.

    Afta Lagos state, na Kano state get di second highest number of registered voters for Nigeria with a figure of 5,921,370 compared to Lagos wey get 7,060,195.

  4. Ogun state governorship election na three horse-race

  5. Compliance remain slow as banks, Nigerians endure circulation of naira notes

  6. Akwa Ibom govnorship candidates sign Peace accord

    Di 15 govnorship candidates wey dey run for election for Akwa Ibom State don colabo to sign peace accord on top di upcoming March 18.

    State Commissioner of Police, Olatoye Durosinmi tell make cnadidates no tok any kain tin wey go cause gbebge as im tell pipo of di state to pack demselves come to vote for dia candidate.

    Durosinmi add knack hand for chest say dem go fit comot without fear of molestation.

    As INEC promise early release of election materials.

  7. INEC don begin distrbution of sensitive materials for Rivers state

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) for Rivers State don begin inspection and distribution of sensitive materials for di Governorship and State House of Assembly elections from di Central Bank of Nigeria CBN headquarters for Port Harcourt di Rivers State capital.

    Inec bin suspend di distribution exercise after dem shift di date of election to 18 March so dem fit reconfigure di BVAS machine.

    Dem dey attend to a total of 17 local goment areas out of di 23 LGAs for Rivers State wey include di 9 LGAs wey dem bin earlier distribute last week but later return back to CBN after di shift in election dates.

    Di LGAs dem dey distribute to na Bonny, Asari-Toru, Akuku-Toru, Port-Harcourt, Obio-Akpor, Ahoada-West, Ahoada-East, Abua/Odual, Degema, Ogba/Egbema/Ndoni, Khana, Andoni, Opobo/Nkoro, Gokana, Eleme, Oyigbo and Tai.

    Dem go attend to di remaining 6 LGAs on Thursday 16 March, 2023.

    Political Party agents and civil society groups as well as security agencies also dey monitor di inspection and distribution exercise.

    Di Party agents advise INEC to ensure a peaceful, free and fair elections and make sure di choice of di pipo count.

  8. How much Ghanaians go pay after over 80% proposed increase in road tolls

  9. INEC no get Politician as di head of dia ICT

    Di Independent National Election Commission don deny tori wey dey go round say dem hire one popular politician, Femi Odubiyi as head of ICT.

    According to statement wey Inec release, tori wey dem call lie comot from Lagos Politician, Olabode George wey accuse di commission say dem hire pesin wey br former Lagos State Commissioner and associate of ogbonge politician.

    INEC hala say dem no get ant Feni Odubiyi wey dey work fo ICT for dem weda for headquarters or state leve.

    Dem also try clear di air as dem say di work of ICT for di organisation na career officers no be by political appointment.

  10. INEC and NSA say election na contest no be war

    Di Chairman of di Independent National Electoral Commission (Inec) Professor Mahmood Yakubu and di National Security Adviser, Babagana Moguni don beg political parties and dia supporters to bone violence.

    Dem make di plea on Tuesday for di Inter-Agency Consultative Committee on Election Security.

    Yakubu tell political parties, candidates and dia supporters to see di election as contest no be war.

    Unlike di presidential election di govnorship elections go get more candidates and more collation centres.

    So di March 18, INEC dey collabo with security to ensure di State elections for 28 states go go smoothly and go involve 1,021 constituencies.

  11. Una Good Morning!

    Dis live page dey cover all di tori as e dey happun ahead of di governorship election on Saturday.

    Dey follow us for all di tori.