You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Inec postpone Enugu East senatorial election
Di independent national electoral commission (INEC) say a total over six million pipo never collect dia permanent voters card two days to di Nigeria presidential and national assembly.
Live Coverage
Victor Ezeama and Jelilat Olawale
Imran Khan: Why supporters of former Pakistani prime minister dey protest go Islamabad?
Who don join Trump team so far?
Fotos: Burial of Anambra senator Ifeanyi Ubah
Why Ghana electoral commission burn thousands of ballot papers before 7 December elections
Why Catholic church for Kenya reject $40,000 donation from President Ruto
Why President Tinubu approve Bwala, Dare as co-tok tok pesins wit Onanuga
Inec declare APC Lucky Aiyedatiwa winner of Ondo governorship election
LGA by LGA breakdown of Ondo governorship election result
Yiaga Africa say case of vote buying dey for Ondo govnorship election
Yiaga Africa, one civil society organisation wey dey chook mouth into electoral matter tok say dem observe cases of vote buying for different polling units for di ongoing Ondo state govnorship election.
Di group tok dis one wen dem dey give dia situation report about di election wia dem tok say dis issue of vote buying dey contribute to electoral corruption.
Remember say BBC capture moments wey some voters begin collect money afta dem cast dia votes for di Ondo State govnorship election. Di open vote-buying occur for unit 016, Ahmadiyya Grammar School, Owo local goment area.
But one oda incident wey Yiaga mention happun for St. Stephen Polling Unit in Ward 4, Akure and men of di DSS bin gbab di pesin wey dey involved for di mago-mago.
Di group say election officials and materials bin arrive early for polling units wey dem observe.
EFCC say dem monitor Ondo state election to find vote buying and selling
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dia men dey ground for Ondo state to find pipo wey involve in vote buying and selling during di election.
According to informate for dia X page, di commission say dem monitor di election to ensure say dem check everi form of electoral offences wey go happun.
"Operatives dey all ova di state in line wit di mandate of di commission to prevent, investigate and prosecute all forms of economic and financial crimes," EFCC tok.Meanwhile, counting for di 2024 Ondo state election don begin.
Ondo state governorship election result live updates
Nigeria Minister for Interior cast im vote for ongoin Ondo election
Di minister of interior Olubunmi Tunji-Ojo don cast im vote for di ongoing Ondo state govnorship election.
Tunji-Ojo wey vote at around 11:34am for im area for polling unit 17, Ward 3, Akoko North-West local govment area of di state.
Di minister say di election dey go peaceful.
"Na peaceful election wit officials wey dey display high level professionalism wit encouraging turn out of voters," di minister tok.
PDP govnorship candidate Agboola Ajayi cast im vote
Di candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Agboola Ajayi don cast im vote for Polling unit 4, Ward 2, Kiribo Apoi, Ede-Odo LGA.
Ajayi wey be 54-year-old na di flag bearer of PDP for dis 2024 Ondo state governorship election.
E appear for im polling unit wia e join di queue for accreditation bifor e move forward to cast im vote.
Why India Prime Minister Narendra Modi dey visit Nigeria
Meet di main candidates for di Ondo state governorship election
Simple guide to di Ondo state gubernatorial election
President Tinubu appoint Daniel Bwala as Special Adviser on media
Four key issues wey fit decide who go win Ondo state govnorship election 2024
'Welcome back' - highlight of Donald Trump meeting wit US president Joe Biden