You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Adeleke defeat Oyetola to win Osun govnorship election

Live updates from Osun state wia residents dey elect dia next govnor.

Live Coverage

Helen Oyibo, Jelilat Olawale and Victor Ezeama

  1. Reports of vote buying comot for Ifelodun, Olorunda area

    More reports of vote buying continue to dey emerge from di govnorship election for Osun state.

    Our tori pesin report say for Olorunda ward 8 unit 21, pipo dey codedly pay voters amount wey range from 5000 naira to 10,000 naira.

    Our reporter see as voters dey approach two men wit "cross bag" and dey tell am say "we don finish" make dem settle dem.

    One party agent wey no wan im name to dey mentioned say, "di vote buying don dey go on since morning."

    "If you look dem well, you go see how dem dey share di money. I just dey look dem". E tok..

    One female voter for ward 4 polling unit 3, di voter for Ikirun, Ifelodun local goment say, "dem approach me but I no gree cellect di money becos I no wan sell am"

    Meanwhile, INEC official don dey ready to conclude voting for some units.

    Di election dey largely peaceful and smooth for Boripe, Olorunda, Osogbo, Ifelodun and Irepodun local goment areas of di state.

    Security dey on guard as voters cast dia ballots.

    Many voters twale INEC for beta job while odas lament slow voting process for some parts of di state.

    Accreditation and voting proper start on time for all di polling units wey BBC Pidgin carry waka enta.

    Di Bimodal Verification Systems BVAs too no disappoint for all di places wey we enta.

    "Di only tin wit di BVAs be say we gats try am multiple times for pipo wey dia foto no dey show well-well, but e dey work well-well". One corper tell BBC Pidgin.

  2. Breaking, Voting don officially close for Osun govnorship election

    Voting don officially end for Osun state govnorship election.

    Inec say voting go start by 8:30am to end by 2:30pm but pipo wey dey queue by dat time go still fit vote.

  3. INEC officials ready to wrap up voting

    From ward 4, unit 007, Ataoja D to ward 6, unit 3, 4, 5, 6, 7 for Isale-Aro, Osogbo local goment area of di state, some voters don cast dia votes and dey wait behind for dia units to witness how INEC officials go sort and count di votes.

    Voting go end at 2.30pm, dis na why INEC ad-hoc staff still dey siddon dey wait for more voters to come vote for dis polling unit.

    Di electoral officers for all di units tell BBC Pidgin say ballot papers still dey available wey mean say pipo still dey wey neva vote.

    Voters wey tok to our tori pipo say dem dey happy wit di process wey dem say dey "peaceful and smooth".

  4. Striking images from Osun govnorship election as vote still dey go on

    See some striking fotos from Osun state wia govnorship election dey happun.

  5. Popular musician Davido say pipo dey reject moni for Osun election

    Nigeria musician, and nephew to di PDP candidate Davido don allege say voters for Osun state dey reject money wey pipo wan use buy dia vote.

    "Pipo dey reject money wey dem offer dem left and right of di state today.", Davido tok as im dey di state to vote and monitor di election.

    Davido bin campaign for im uncle, Senator Adeleke wey also dey contest under di PDP to win di gonorship election.

    Di 'OBO' crooner say dis rejection of money by voters mean say hope still dey for di kontri.

    Meanwhile, BBC Pidgin gada reports say vote buying don emerge for some polling units for di ongoing governorship election..

    Majority of di reports dey come out for Ife area of di state.

    One voter wey no gree make we mention her name say political parties dey negotiate price wit voters.

    Di voter say one political party offer her N5,000 while anoda party promise am N8,000.

    Di Nigeria police force don tok say dem go work wit anti corruption agency, Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to make sure say vote buying during di election for Osun no happun.

  6. Reports of vote buying emerge for Osun election

      • Author, Victor Ezeama
      • Role, BBC Pidgin

    Reports of vote buying don emerge for some polling units for di ongoing governorship election for Osun state.

    Majority of di reports dey come out for Ife area of di state.

    One voter wey no gree make we mention her name say political parties dey negotiate price wit voters.

    Di voter say one political party offer her N5,000 while anoda party promise am N8,000.

    "E surprise me say some pipo dey collect di money. But dia target na old women and men," di voter tok.

    Vote buying na electoral crime wey don begin dey common during election for Nigeria. For di just concluded election for Ekiti state, cases of vote buying dey well well, according to election observers.

    Di same incidents don begin happun for Osun election. BBC Pidgin no fit take foto for fear of being attacked by political party supporters.

    Nigeria anti corruption agency, Economic and Financial crimes commission (EFCC) dey for Osun to reduce cases of vote buying.

    On Friday, Muyiwa Adejobi, police tok-tok pesin for Nigeria say officers go work wit EFCC to arrest pipo wey dey buy or sell votes.

  7. Voters lament slow voting process for Olorunda ward 8, Unit 3

      • Author, Jelilat Olawale
      • Role, BBC Pidgin

    Voters for ward 8 unit 3 wey dey Olorunda local goment area dey lament bitterly over wetin dem slow process.

    Some of di voters wey tok to BBC Pidgin say di queue no dey move since dem land for di unit.

    Adekunle Babatunde, say e believe di electoral officers wey dey ground no dey enough for di voters wey dey present.

    As at 12 noon, plenti voters dey on top queue under di sun and many odas siddon dey wait for dia turn.

    “I don here since 9am and I never vote. I no even dey sure say e go reach my turn before 2:30pm” anoder voter lament.

    Security operatives dey manage di crowd wey dey struggle to cast dia vote and voters say di slow process no go dtop dem from voting..

  8. 'Di voting process don change from how e be before' - 90 year-old-voter

    Mama Caroline Adebimpe Adewale na 90-year-old, senior citizen wey don vote for di ongoing election.

    She say di verification, accreditation and voting no take her more dan two minutes.

    "Voting pattern don really change from how e dey be before. I no waste time at all and I don vote who I want," she tok for Yoruba.

    Dis election for Osun state see many voters of different ages come out - those wey don dey vote since Nigeria independence and first time voters.

    Di 90 year old woman say, "I believe say tins fit still change and I go take my eye see di change."

  9. 'Osun election smooth so far'

      • Author, Victor Ezeama
      • Role, BBC Pidgin

    Di govnorship election for Osun state dey go smoothly so far.

    Nobody don report any case of violence for any part of di state as at 10:00am.

    For Osogbo, Boripe, Ede North and South, Ife Central, East, North and South, Ila and oda local goment areas election start early.

    Security pipo full everi wia to ensure safety of voters and pipo wey dey work today. Dem also mount check point for strategic locations for di state.

    Nigeria anti corruption agency, EFCC also dey on ground to arrest pipo wey dey buy and sell dia votes.

    So far, complain neva dey say di Bvas machine wey Inec dey use for di election don fail any wia.

  10. Election observers, security officials tanda for Iragbiji

    Accreditation of voters and voting proper start at exactly 8:30am for ward 1 polling unit 2 of Iragbiji, Boripe local goment.

    Voters from di young pipo to di older citizens in dia numbers queue to do accreditation in di middle of tight security.

    Election observers dey monitor di process wey so far dey go well- well.

    Voters wey tok to our tori pipo say dem go sell dia votes as na dia right e be.

    Dis na di polling unit wia APC candidate, Gboyega Oyetola cast im vote.

  11. ‘E sure me say dem go re-elect me’ - Oyetola

    Di govnor vote immediately afta im wife, Kafayat bin cast her own vote for di same unit.

    So far, everytin dey go smoothly and di election never witness any kain wahala.

    Some international observers also dey follow monitor di election as we sight dem for Boripe

    APC candidate and di current govnor of Osun state, Gboyega Oyetola say im get confidence say dem go re-elect am for a second term.

    “I get confidence say di pipo go re-elect me,” e tok.

    Oyetola tok afta e cast im vote at exactly 10:50 am for ward 1 polling unit 3 Iragbiji area of Boripe local goment.

  12. Video show how Oyetola vote

    APC candidate and Govnor of Osun state Gboyega Oyetola don cast im vote.

    Di govnor vote some few minutes before 11:00am for im polling unit for Iragbiji area of Boripe local goment.

    See video of how and wen e vote below.

  13. Breaking, Oyetola don vote

    Osun state Govnor and APC candidate for di 2022 guber election for di state, Govnor Gboyega Oyetola don cast im vote.

  14. APC candidate Adegboyega Oyetola wit im wife land dia polling unit to vote

    Osun State Govnor Gboyega Oyetola wit im wife come don land dia polling centre for Iragbiji area of Boripe local goment to cast dia vote.

    Di sitting govnor dey seek re-election into office for di second time.

  15. LP candidate Yusuff Lasun don vote

    Labour Party candidate Yusuff Lasun don cast im vote.

    E cast im vote for Ward 5A, Unit 4, Woru, Irepodun local goment, Ilobu.

  16. Di moment PDP candidate Senator Adeleke cast im vote

    See di moment PDP candidate Senator Ademola Adeleke cast im vote for di Osun state govnorship election wey dey happun.

    Senator Adeleke na one in di 15 candidates wey dey contest ro lead di state for di next four years.

  17. 'So far so good, everytin dey calm' - Adeleke

    Di PDP candidate tok to tori pipo afta e cast im vote for for im polling unit for Ede North of Osun state.

    "So far so good, everytin dey calm and we hope e go stay dat way... E dey fantastic, Inec don improve." Na so e tok.

    As for weda e don here any tori about vote buying, Senator Adeleke say e still too early to tok.

    "We just start and we dey watch. We want dis election to be a point of contact for 2023." E tok.

    Watch di moment e vote for di video below.

  18. 'I never miss voting since Awolowo era'

    Pa Olatunji Ojo, wey dem born for 1947 say e neva miss voting since e don dey vote from Awolowo time.

    Di old man wey come wit im wife say na im right to vote and e dey always make am happy to exercise im right.

    "I don dey vote since Obafemi Awolowo time. E dey always sweet my belle to vote becos na my right." E tok.

    Pa Ojo na one of di senior pipo wey don show face to cast dia votes for di ongoing Osun govnorship election.

  19. Breaking, PDP candidate Senator Adeleke don vote

    PDP candidate Senator Ademola Adeleke don vote for im polling unit for Ede North of Osun state.

    Senator Adeleke wey contest for di last election for 2018, na one of di favourites to vote.

  20. Inec officials address voters for Oyetola polling unit as DSS, police full ground

    Inec officials dey address voters for polling unit 2, ward 1 for Iragbiji area of Boripe local goment.

    Dis na di unit wey APC govnorship candidate for di election, Govnor Gboyega Oyetola go cast im vote.

    Oyetola na native of Iragbiji.

    INEC officials tell voters say na total of 1457 pipo dey registered to vote for di unit.

    Operatives of di DSS and men of di Nigeria Police Force dey ground to monitor di process.

    Oyetola na one of di 15 candidates wey dey contest for di election.