Na today dem
go announce who win di Big Brother Naija Lockdown season afta about seventy
days wey dem don dey house.
Di season
bin start with twenty housemates and dem don drop to dia last five: Laycon,
Neo, Vee, Dorathy and Nengi.
Laycon na
rapper wey im fans dey call demselves Icon. Im don chop nomination for evition
two times since dem introduce di eviction rule for di end of August. Im dey
popular for di house sake of di advice wey im dey normally give and im
involvement for di Kiddrica (Kiddwaya and Erica) and Ozone (Ozo and Nengi)
ships.
Dorathy na
anoda pesin wey many pipo tink say go be contender as pipo dey hail her fans D’Explorers as 'silent voters.' So far, her popularity comot from how she dey
relate with fellow housemates and her involvement for di Ozone and Brighto and
Wathoni ships. She bin dey up for eviction di time wey Ozo leave house.
Neo and Vee
be like package deal for di house as na dia couple tins don make dem popular for
di show. Neo also get im talent wey don help am win challenges for house and
Vee dey popular on top her bluntness for things wey happun for house like
Laycon crush on Erica.
Nengi na one
of di pipo wey don win challenge gifts most for di house and dey popular
because of her 'ship' wey no sail with Ozo and her friendship with Laycon. Nengi
don dey up twice for possible eviction.
See wetin fans get to tok about di mata.