You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

All di serenren from AMVCA awards as e dey happun

Dis na we live coverage of di seventh edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards wey dey go down for Lagos, Nigeria.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Best Indigenous Language Movie/TV Series - Hausa

    And di winner na...Muhammad T. Finisher

  2. Best Indigenous language Movie/TV Series - Swahili

    Raveet Sippy Chadh na di winner of dis category.

  3. Best writer for Movie or TV series

    Nicole Asinugo and CJ Obasi for di movie Living in Bondage

  4. Best Soundtrack (Movie or TV series)

    Larry Gaga and Flavour na dem win dis category for di movie Tene

  5. Best Documentary

    And di winner is....Beverly Naya for her documentary Skin

  6. Best Cinematographer

    John Demps don collect di award for di movie Living in Bondage

  7. Sweet Boys Association

    Lawmakers for Nigeria, senators Ike Ekweremadu, Enyinnaya Abaribe, Dino Melaye and DSTV CEO John Ugbe don join as members of Sweet Boys Association?

    We go soon find out

  8. Best lighting designer in a movie or TV series

    And di winner is...Cardoso for di movie God calling.

  9. Best Sound Editor (movie or TV series)

    And di winner of Best sound editor goes to...Christina Aragon for di movie Living in bondage

  10. Best Picture Editor

    Tosin Igho and Bryan Dike dem two na im win di category for Best Picture Editor.

  11. Best make up category

    Lilian omozele Paul don carry di award for Best make up category for her workd for di movie God Calling.

  12. Best costume designer (Movie or TV series)

    Dimeji Ajibola na im win dis category for di movie Ratnik

  13. Best make up category

    Lilian omozele Paul don carry di award for Best make up category for her workd for di movie God Calling.

  14. Winner of best art director (movie or TV series)

    Dimeji Ajibola and Iwaotan Olusola Roberts na dem win dis category for dia film 'Ratnik'

  15. 'Coronavirus on di red carpet'

    Dis na night of awards but di tori of coronavirus no dey lost on our movie actors.

    As seen on di red carpet, Ada Afoluwake Ogunkeye wear dress wey be like e get face mask.

  16. Suits for comedians, tuxedo for lawmaker

    Normally na movie pipo dey sara for AMVCA, but we don site one or two comedians and even one former lawmaker for Nigeria wey turn up.

    From Basket Mouth to Funny Bone, down to Senator Dino Melaye, dis night no be only for movie stars.

  17. 26 categories of awards for 26 winners

    Dis year edition of di AMVCA go see winners comot from 26 different categories of di award.

    Among di categories seven bin dey open to public voting and dem be:

    • Best Supporting Actress
    • Best Supporting Actor
    • Best short film or online video
    • Best actor in a comedy
    • Best actress in a comedy
    • Best actor in a drama
    • Best actress in a drama
  18. One by one dem don dey come

    As di time of di award don dey draw near, big movie stars from everi wia for Africa don dey arrive di Eko Expo Hall, Victoria Island for Lagos State, Nigeria.

  19. Welcome

    Tuale for everibody wey just dey join dis BBC Pidgin live update of di 2020 edition of di Africa Magic Viewers Choice Awards wey dey go down for Lagos.

    Na for dis live update we go dey sama una di winners and losers of dis year award as e dey hot.