Di Independent National Electoral commission (INEC) for
Delta State south-south Nigeria don tell pipo for di state say make dem no fear to come out cast
dia vote on election because enof security dey to protect dem.
Di INEC Resident Electoral Comissioner inside the state, Cyril Omorogbe way follow BBC Pidgin tok, say:
"My
advise be say make pipo follow directions and law plus make dem no allow pesin
give dem money to vote for dem."
"Make
pipo no come like say dem dey ready to fight, make dem come like say dem dey
come watch football and wen you finish go home in peace. "
Oga Omorogbe
say INEC no get any big challenge way dem dey face for di election
inside di state but e add say some places dey wey pipo dey complain but
im pray make e be say dem solve those problem before di election.
"Some of di complain na from pipo wey be say dem get
complain wey don dey tey like 20years ago and now dem want make you come fix di
problem because election dey come in two days.
"Some towns dey say goment don take dia land, job,
take dis and dat, so dem go come complain say dem no want election, make e no
hold. But my own reply be say dis one no be time wey you go take complain, if
you wan complain afta election you fit come out to tell pipo wetin your palava be.
Al these no go fit stop do election.
E conclude say all those complain no concern INEC.