BBC Pidgin Team full ground
Harry Itie, BBC Journalist post dis foto for social media to show im ginger for di debate.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
We don invite five candidates wey go ansa kweshion about dia policies and how dem wan take move di Rivers State forward.
Olu Okunnu
Harry Itie, BBC Journalist post dis foto for social media to show im ginger for di debate.
Hear from di BBC Pidgin Editor, Adejuwon Soyinka as im tok about di different ways wey pipo fit follow today debate so dat dem no go miss anytin.
Im also tok about how pipo of Rivers State take tell us who and who dem want make we invite for di debate.
Use di hashtag #BBCGovDebate and #BBCPidginDebate to ask di candidates qweshion or to drop your comment.
Stay wit us on dis Live page and we guarantee say you go get ogbonge updates on how di debate dey go – as e dey hot!
Today by 10am sharp, govnorship candidates wey dey contest for Rivers State, south-south Nigeria, go share wetin dem wan do for dia pipo if dem become di next govnor.
We welcome una to di Rivers State govnorship debate wey we package as part our preparation for di 2019 elections for Nigeria.