You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Ivory Coast begin Afcon 2023 wit victory over Guinea Bissau

Hosts Ivory Coast begin di 2023 Africa Cup of Nations wit comfortable 2-0 victory over Guinea-Bissau.

Live Coverage

Moseph Ekine

  1. Salah go fit win Afcon 2023 title even wit di strong contenders?

  2. Everytin you need to know about Afcon, Ivory Coast vs Guinea-Bissau (20:00 GMT)

    Di 2023 Africa Cup of Nations don draw, Ivory Coast dey host di finals for di second time.

    Di tournament go kick off on Saturday, 13 January, wen di host go face Guinea-Bissau for Alassane Ouattara Stadium for Abidjan.

    Record seven-time champions Egypt go also dey action on di opening weekend, dem go face Mozambique for Group B, while Senegal wey dey hold di cup go begin di defence of dia title against Di Gambia for Group C on Monday, 15 January.

    But wen di oda group fixtures go occur? Wetin be di format of di tournament? Wia dem go play di matches and wen dem go kick off?

  3. , Ivory Coast vs Guinea-Bissau (20:00GMT)

    Hosts Ivory Coast wey don win di tournament two times for 1992 and 2015 go play in front of dia fans.

    Check out how dem arrive di stadium.

  4. Welcome!, Ivory Coast vs Guinea-Bissau

    Afta long wait for di start of di biggest football competition for Africa, di Cup of Nations don set to begin.

    Welcome to BBC Pidgin live-text update of di opening match of di 2023 Afcon between Ivory Coast vs Guinea-Bissau.