56 mins
Samuel Chukwueze get di beating of Sandro Tonali, wey drag im back on di right edge of di Newcastle box. Di away side get defending to do.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Among all di English teams, na Newcastle dey wetin many pipo believe say na di toughest group wit di likes of Paris St-Germain, Italian giants AC Milan and former Champions League winners Borussia Dortmund.
Tunde Ososanya and Victor Ezeama
Samuel Chukwueze get di beating of Sandro Tonali, wey drag im back on di right edge of di Newcastle box. Di away side get defending to do.
Newcastle dey do well for dis second half.
Jacob Murphy dey for space on di right and im cross forces Mike Maignan to dive from im goal to punch away.
Milan first real attack of di half na wen Alessandro Florenzi pop up between di Newcastle defence and midfield to gada a pass, turn and den fire a low, dribbling shot wide.
Newcastle dey certainly dey more proactive for dis second half sha.
Jacob Murphy go for glory wit a shot from one angle and 40 yards out. Im fail to find am.
If Pat Nevin tink say na booking, who I be to argue?
Fabian Schar leap wit Tommaso Pobega and leave im elbow on di back of di Milan man head. Na di kain tin wey you dey see for evri game, evri week. Schar get booking for am sha.
Positive start from Newcastle.
Anthony Gordon set up Sandro Tonali for an effort from di edge of di box wey dey blocked.
You suspect di Italian go be a 'no celebration at your old club' kinda fella.
Milan manager Stefano Pioli bin dey chat wit Christian Pulisic and Tijjani Reijnders just before di game start again. No dey surprised if we see dem soon if tins no go as planned for Milan.
Newcastle no fit get anoda half like di first half. Dem fit likely lose di match if dem play like di first half.
Dem gatz give Milan sometin to worry about.
Not one second of added time for di end of di half.
Newcastle bin know say dis Champions League lark go be proper test. Dem don dey on di back foot for most of am so far. Dem don dey bent out of shape at time, but dem neva dey broken yet.
Malick Thiaw of AC Milan make rough challenge and Jose Maria Sanchez blow im whistle for foul.
Milan captain Davide Calabria get too much to say to di ref and im get one booking. Not sure wetn im dey unhappy about?
Di game dey interrupted. Ruben Loftus-Cheek of AC Milan don violate di rules for di battle for di ball. No protests or gestures dey as im dey aware of wetin im do.
Samuel Chukwueze dey inside di box in a promising position to head home! Im poor header fly into di stands. Dat na poor effort! Di ball dey off of di pitch and na goal kick for Newcastle.
Ruben Loftus-Cheek (AC Milan) rob one opponent of di ball and explode in anger wen Jose Maria Sanchez blow for foul.
Rafael Leao beat one man and den drive for di box. Im weaves brilliantly past two men for di area but wen di crucial moment come to shoot im try for a backheel wey cause am to fall ova.
Di danger neva dey ova, sake of say Newcastle and Nick Pope gatz dey alert to save one shot from Malick Thiaw afta Tommaso Pobega effort dey blocked.
Immediately down di oda end and Olivier Giroud get di chance to shoot from close range. Di angle tight and im no fit steer im effort on target.
Sean Longstaff tumble for di box. Im dey look for di foul. Di referee dey quick to wave away any chance of a penalty. Why im no stay on im feet and shoot?
Replays show say Rafael Leao shove am small, but shey dat one dey enough to send am down or stop am from shooting?!
Well, Newcastle don make am to di 30-minute mark and di game still dey for 0-0.