You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Kudus, Nuamah goals secure Afcon 2023 place for Ghana
Di coming in of Semenyo raise di tempo wey make di same player set up Ernest Nuamah for di second and winning goal.
Live Coverage
Victor Ezeama and Fiona Equere
Latest Champions League results and table
Wetin dey behind Ghana post-election kasala?
Wat next for Ghana new president John Mahama
Final result of Ghana 2024 presidential election result
Region by region breakdown of Ghana 2024 presidential election results
John Mahama declared winner of Ghana presidential election
How Ghana ruling party fall, lose 2024 election to opposition
Actor John Dumelo win MP seat for Ghana election
Ghana electoral commission say result neva reach di collation center
Di Electoral Commission for Ghana say dem neva receive any results for di National Collation Centre yet.
Dis na di latest from di Director of Electoral Services, Mr. Benjamin Bano-Bioh from di National Collation Centre.
According to di director, e say informate from di field be say results still dey come in to di Regional Collation Centres, and di Commission no fit publish any results yet.
Di electoral services director also say di reason why di delay bin dey be say some of di Constituency Collation Centres dey attacked, wit destruction of election materials.
Di director also clear say na wen dem receive di results from all di 16 regions bifor dem go begin announce and publish am.
Meanwhile, local media dey report say touts set ballot materials ablaze and also lock up media pipo for Techiman South of di kontri.
Movement for change presidential candidate Alan Kyerematen congratulate Mahama
Di presidential candidate of di Movement for Change party in Ghana, Alan John Kwadwo Kyerematen don send congratulobia to former President John Dramani Mahama.
Dis dey come afta di ruling New Patriotic Party (NPP), Mahamudu Bawumia bin concede defeat to di opposition National Democratic Congress (NDC) for di 2024 presidential election.
Although di Ghana Electoral Commission neva give any official announcement of results, but congratulation don dey pour in for Mahama.
According to Kyerematen, e say e dey clear say Ghana bin speak wit dia votes.
"I go like to congratulate former President John Dramani Mahama and di National Democratic Congress (NDC) for an emphatic victory for di just concluded 2024 General Elections."
"I dey urge all Ghanaians to accept di decision of di Ghanaian electorate once di official results dey released so as to preserve di peace of our dear nation," Kyeretan say.
Mahamudu Bawumia ruling NPP candidate concede defeat to John Mahama
Ghana Police gbab man wey carry weapon come polling station
Authorities for Ghana don gbab one man wey carry weapon for polling station during di ongoing Ghana election.
Dem gbab di man for St.Theresa school polling station for di Okaikwei South constituency for Accra.
According to police for Ghana, di suspect go help dem with more informate and dem go investigate am.
US, UK send message give voters for Ghana
Di US Embassy for Ghana don send message give voters for Ghana say make dem ensure peaceful and transparent elections.
"We doff cap for evri body wey dey stand for election today and to all of dos volunteers, election observers, and security forces wey dey work to ensure peaceful, credible and transparent elections".
Also, di UK embassy for Ghana say make voters uphold credible election.
Canada also chook mouth for di Ghana election wia dem dey preach free and fair election.
"Di High Commission of Canada wish all Ghanaians an inclusive, free, fair and peaceful election.
Meanwhile, election don dey enta serious stage as voters don come out fully to cast dia vote.
All don set as Ghanaians ready to vote new president
NPP vice presidential candidate cast im vote for Kumasi
Di vice presidential candidate of di governing NPP, Dr Mathew Opoku Prempeh don cast im vote for Kumasi.
NPP and oda political parties go battle am out for dis election wit ova 18million voters.
Breaking, Ruling NPP presidential candidate Mahamudu Bawumia cast im vote
Di Vice president of Ghana wey also be di candidate for di New Patriotic Party (NPP) Mahamudu Bawumia, don cast im vote for di ongoing Ghana election.
Bawumia cast im vote for di Walewale constituency of di Savannah Region for Ghana.
Bawumia, wey currently be Ghana vice-president, na from di governing New Patriotic Party (NPP) as dia candidate wey dem choose for di forthcoming general election.
Bawumia bin rise from being a political outsider to become Ghana second-in-command - and on 7 December e fit make history as di kontri first Muslim president.
Fifa club world cup draws for 2025
How much e cost to do, win election for Ghana?
How di new format of Club World Cup go work & why e dey so controversial?