Most govnors across Nigeria 36 states don
react to di #EndBadGovernance protest wey dey go on across di kontri.
Ahead of di protest, some state govnors bin tear warning give dia pipo say make dem no
follow join di protest, odas call for patience, say make dia pipo dey patient wit
di current administration as tins go still beta.
One of dem na di Lagos State Govnor Babajide Sanwo-Olu, wey say di state no go allow
wetin happun for 2020 #EndSars protest wia youths enta street to call for di disbandment of di Special anti-robbery squad police unit, reoccur again for di state.
E say di protest bin start on peaceful note bifor jaguda pipo hijack am wey lead to destruction of property and looting.
Di govnor say protest no go bring di progress di
kontri need now and e no go make di challenges wey di kontri dey face disappear
in 10 days. E no go lower di prices of food or bring about economic growth
instead e go scata di progress wey di goment don make.
E tok of di new minimum wage bill di president pass
into law, di student loans plus wetin im don do for di state to stabilise di
economy and assure say “we go do more and we will”.
Also di Rivers State Govnor Sir Siminalayi Fubara bin
tok say credible informate dey ground say some mercenaries and thugs don
hire pipo from outside, under di guise of protest, to destroy valuable
infrastructure assets for di state.
Fubara say true-true Nigerians dey face economic hardship
but add say di federal government, under President Bola Tinubu dey take
believable actions to address di current hardship and secure beta future for di
pipo.
Imo State Govnor Hope Uzodinma also say make pipo no protest as
jaguda pipo fit hijack am and e fit lead to serious kasala.
E say make kontri popo dey patient and trust goment plans as e add say dem don start plenty interventions and programmes wey dey aimed at providing
immediate relief.
Edo State Govnor Godwin Obaseki tok say im stand
wit Nigerians ova di hardship and difficulties dem gatz endure particularly ova
di last one year, wey e say come from various policies wey di Nigerian goment
implement.
However, e appeal to di organisers of di protest to
consider oda forms of protest instead of demonstration on di streets.
E assure dem say di state goment don mobilise
security agencies to dey on high alert and provide protection for genuine
protesters.
Oda govnors also ask citizens to exercise patience
as Tinubu goment don initiate economic reforms wey go yield beta fruits for di
kontri.