You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Donald Trump make history as e win US presidential election

Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House

Summary

  • Donald Trump don win di US election and go make a historic return to di White House
  • Of di seven key swing states, Trump win North Carolina, Georgia, Pennsylvania and Wisconsin, and dey ahead for Michigan, Nevada, and Arizona
  • Kamala Harris never concede yet or address supporters - unhappy crowds comot her watch party before di final result come in
  • Republicans don also take di Senate back from Democrats after dem flip some seats
  • World leaders don congratulate Trump
  • Nigeria President Bola Tinubu congratulate Donald Trump

Live Coverage

Helen Oyibo, Adebola Ajayi, Kareemot Salami, Victor Ezeama and Fiona Equere

  1. European leaders congratulate Trump

    As Europe dey wake up to di news say Donald Trump dey likely to win di US election, dis na how some leaders dey react:

    • French President Emmanuel Macron say Im dey "ready to work togeda" wit Trump for a second time
    • Meanwhile, Ukraine President Volodymr Zelenksy congratulate Trump and praise im commitment to "peace through strength" – wey im say go "bring a just peace for Ukraine closer"
    • Mark Rutte, Nato secretary general, share Zelensky sentiment and say Trump leadership dey "key" sake of " growing number of challenges globally"
    • Italy Prime Minister Giorgia Meloni praise her kontri "unshakeable alliance" wit US and add say na bond wey go "strong more" wit Trump
    • Petr Fiala, di Czech prime minister, say im want " ensure say di relations between kontris remain at di highest level ... and add say we go kotinu to develop dem for di benefit of our citizens"
    • We dey yet to hear reaction from Russian President Vladimir Putin
  2. India Prime Minister congratulate Donald Trump, say e dey look forward to India-US relationship

    Di Prime Minister of India Narendra Modi don congratulate Donald Trump for di ongoing US election.

    For im post for X, Modi say e dey look forward to renew dia collabo to help di India-US partnership.

    "Togeda, make we work for di bertterment of our pipo and to promote global peace, stability and prosperity."

  3. About last night - Election night as e happun

    Donald Trump dey four electoral college votes away from being declared di 47th president of US.

    Afta a busy night - one wey no dey close like di polls suggest – dis na some of di key moments:

    • Trump deliver victory speech to im supporters for Florida, moments afta dem call di key swing state of Pennsylvania in im favour, e vow to heal di kontri and send US into a "golden age"
    • CEO of X Elon Musk dey among those wey receive a shout-out from Trump, e describe am as a "new star" of di Republican Party, while im running mate JD Vance describe Trump win as "di greatest political comeback ever"
    • For contrasting scenes, Kamala Harris supporters leave dia official watch party for Washington DC early, images show untouched American flags for carboard boxes
    • So far three swing states, Pennsylvania, North Carolina and Georgia, dem call dem for Trump – im dey ahead for di four wey remain: Arizona, Nevada, Wisconsin and Michigan
    • Minnesota and New Jersey na some of di states wey dem don call for Harris, wey, along wit reliably blue areas, put her at 219 electoral college votes so far
    • Meanwhile, the Republican Party also dey set to take control of di Senate; di Democrats fai to unseat Ted Cruz forTexas, wey be on one dia key targets

    Counting still dey go on for a handful of states, so stick with us as we wait to hear those results and bring you all the latest.

  4. Nigeria President Bola Tinubu congratulate Donald Trump

    Nigeria President Bola Tinubu don send congratulatory message give Donald Trump as di US election dey go on.

    President Tinubu say im dey look forward to how Nigeria and di US go begin strengthen di ties wey dey between dem.

    “Togeda we fit collabo on economic cooperation, promote peace, and address global challenges wey dey affect our citizens,” President Tinubu.

    Dis message dey come for time wey di US election dey go on and Trump dey lead for votes wey don come in.

    Nigeria president say e believe say Trump get experience and go use am bring di worl "closer to peace and prosperity."

  5. Trump supporters dey 'super happy' and 'feeling grateful'

    Di mood wey dey outside di Palm Beach Convention Centre around 04:00 dey happy as Donald Trump supporters dey come out of im election night party.

    Pickup trucks wey dey drive passdey blow dia horns and anoda man on a motorcycle dey play Trump song.

    Fatima Henges, 30, dance across di street as she leave di party tonight and say she dey "happy, super happy" about di results so far.

    "We no wan go home, but we gatz go work tomorrow," she say. "I tink say e dey good for everyone, na change."

  6. Some democrats don begin analyse wetin happun

    For some Democratic Party circles, dem don begin analyse di election even though dem neva officially call di results.

    One Democrat political operative for DC texts to say di party "need to flush out elitist snobs for DC for a start".

    Odas tell me di same tin – while dem praise di efforts of di campaign, dem feel say di party as a whole get 'image problem' at a time wen basic, evri day tins like di cost of living dey most voters mind.

    Dis Democrat mata remind me of di conversation I bin get wit one Republican for one Trump rally wey say dia candidate don completely "reimagined" di Republican party from im kontri club voter stereotype to appealing to working class families, while di Democrats don become di "party of Hollywood".

    Dis na big generalisations, but ones Republicans publicly, and some Democrats privately, now dey share.

  7. UK prime minister say e dey look forward to work wit Trump

    Keir Starmer na anoda next world leader to congratulate Donald Trump on wetin e call a "historic election victory".

    "I look forward to work wit you for di years ahead," di UK prime minister tok.

    “As di closest of allies, we stand shoulder to shoulder for defence of our shared values of freedom, democracy and enterprise.

    “From growth and security to innovation and tech, I know say di UK-US special relationship go kontinue to prosper on both sides of di Atlantic for years to come.”

  8. Nigeria Chief of Army Staff Lt Gen Taoreed Abiodun Lagbaja don die

  9. Wetin Trump tok for im victory speech?

    Donald Trump don declare victory for US presidential election, im deliver speech to im supporters for im watch party for Florida.

    In case you miss am, dis na wetin im tok:

    • Trump thank voters: "I wan thank American pipo for di ogbonge honour of being elected as una 47th president and una 45th president"
    • Im say im don win di popular vote: Dem still dey count di votes, but Trump dey set to win di majority of votes for dis election. "America don give us ogbonge and powerful mandate," Im tok
    • JD Vance "turn out to be a good choice": Trump praise im running mate, wey say Trump just pulloff "di greatest political comeback for American history" during di speech
    • Elon musk na "star": A part of Trump speech im dedicate am to di tech billionaire, Trump call am "an amazing guy"
    • RFK Jr go "make America healthy again": Trump appear to suggest Robert F Kennedy Jr - di former independent presidential candidate, wey get history of supporting conspiracy theories about vaccines – go get role relating to healthcare for im administration. Kennedy withdraw from di race for August to endorse Trump
  10. Israeli PM congratulate Trump 'on history greatest comeback'

    As Donald Trump declare victory for dis presidential election, some world leaders don start to congratulate am.

    "Congratulations on history greatest comeback! Your historic return to White House go offer a new beginning for America and a powerful recommitment to di great alliance between Israel and America," na so Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu.

    Im add say: "Dis na huge victory!"

    And Hungarian Prime Minister Viktor Orban say sometin similar: "Di biggest comeback in US political history! Congratulations to President Donald Trump for im ogbonge win. A much needed victory for di World!"

    UK prime minister say im dey look forward to work wit Trump

    Keir Starmer congratulate Donald Trump on wetin im call "historic election victory".

    "I dey look forward to work wit you in di years ahead," UK prime minister tok, and add say:

    “As di closest of allies, we dey stand shoulder to shoulder in defence of our shared values of freedom, democracy and enterprise.

    “From growth and security to innovation and tech, I know say UK-US special relationship go kotinu to prosper on both sides of di Atlantic for years to come.”

    French president Emmanuel Macron say: ‘’Congratulations, President I dey ready to work togeda wit you as we bin do for four years. Wit your conviction and my own. Wit respect and ambition. For more peace and prosperity.’’

    As a reminder: Trump don declare victory - but im neva reach di required number of electoral college votes. Im just need four to reach 270. Kamala Harris dey on 219.

    As Donald Trump declare victory for dis presidential election, some world leaders don start to congratulate am.

    "Congratulations on history’s greatest comeback! Your historic return to White House go offer a new beginning for America and a powerful recommitment to di great alliance between Israel and America," na so Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu.

    Im add say: "Dis na huge victory!"

    And Hungarian Prime Minister Viktor Orban say sometin similar: "Di biggest comeback in US political history! Congratulations to President Donald Trump for im ogbonge win. A much needed victory for di World!"

    UK prime minister say im dey look forward to work wit Trump

    Keir Starmer congratulate Donald Trump on wetin im call "historic election victory".

    "I dey look forward to work wit you in di years ahead," UK prime minister tok, and add say:

    “As di closest of allies, we dey stand shoulder to shoulder in defence of our shared values of freedom, democracy and enterprise.

    “From growth and security to innovation and tech, I know say UK-US special relationship go kotinu to prosper on both sides of di Atlantic for years to come.”

    French president Emmanuel Macron say: ‘’Congratulations, President I dey ready to work togeda wit you as we bin do for four years. Wit your conviction and my own. Wit respect and ambition. For more peace and prosperity.’’

    As a reminder: Trump don declare victory - but im neva reach di required number of electoral college votes. Im just need four to reach 270. Kamala Harris dey on 219.

  11. Trump dey on course to win popular vote as well

    As tins stand, Donald Trump dey set to win di popular vote - i.e., win di most votes in total - something wey im no even do for 2016.

    Im don vow retribution and revenge if im go back to di White House.

    Im also vow di biggest deportation of migrants in history, more tariffs on foreign trade and promise to end di war for Ukraine and Middle East – although im never tok how im go do am.

    Di list of tins im plan to do plenty. But im get im mandate

    So there's a shopping list of all shopping lists there. But he has his mandate.

  12. Donald Trump appear wit im wife and campaign pipo

    Donald Trump take to di stage for im campaign watch party for West Palm Beach, Florida, wia large crowd cheer am up.

    Although, Trump neva win yet becos e still get four electoral college votes to clear bifor e fit dey qualified for victory.

    Wen Trump appear for stage, odas wey dey wit am include im running mate JD Vance, wife Melania Trump and campaign staff.

  13. 'We go help our kontri heal' - Trump

    Trump say: "We go help our kontri heal."

    Im promise to fix di borders, and add say him and im party make history for a reason. Clearly di Republican candidate dey use dis as im victory speech.

    Trump also say dis go be di "golden age" of America.

    "Dis na magnificent victory for di American pipo, wey go allow us to make America great again," im add, as in use im campaign slogan and catchphrase.

    Trump declare victory, although im neva achieve di official required electoral college votes yet.

  14. Una welcome to our second day of di coverage of di US election 2024.

    Make you tanda wit us as we bring una up to date informate as e dey happun,