Tinubu call for peaceful election in Ondo state
President Bola Tinubu don ask political stakeholders and electorate to uphold peace and decorum, and fulfil dia civic responsibilityes without fear bifor and afta di elections.
Di Nigeria leader bin give di informate on Friday, 15 November, ahead of di Ondo state govnorship election.
For one statement from di presidency, Oga Tinubu say im dey look forward to a democratic process for di state wey go genuinely reflect di will of di pipo and power ro freely choose dia leaders.