Communications
officer of di opposition NDC say di party get hope say dey go win three
constituencies for di Ashanti region wey currently dey under challenge.
Oga Sammy
Gyamfi for one press conference say “we dey confident say afta dem solve di
challenge wit dis three constituencies, we go win those seats.”
Dis three
constituencies na Mankraso, Obuasi East and Tepa.
According to
di NDC tok tok pesin, dem don retain dia 4 seats for di Ashanti region wia dem
add 3 extra seats to make it 7 seats so far.
Im tok say
if “we know say afta dis three constituencies wey dey under challenge, we go
win dem also, to make it 10 seats for di region wia be di strong hold of di
goment NPP.”
Di Ghana
Electoral commission neve release any official result.
Meanwhile di
party don dey vex for di electoral commission as dem accuse dem of delaying di
collation of results for di constituencies and di regions across di kontri